You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Some key events wey go happun for 2026
- Author, Faith Oshoko
- Role, Journalist
- Read am in 5 mins
2026 don land and wit am some events wey world pipo fit look forward to.
From sporting events to world politics even down to di entertainment industry, events yapa for dis year.
Dis na some of di events wey dey happun.
2026 World Cup
Di 2026 Men's World Cup go be di biggest one in history as e go get 48 kontris wey go compete against demselves. Dis na as e get 16 more teams dan for di 2022 Qatar World Cup.
Di World Cup dey co-hosted by three different kontris wey include di United States, Canada and Mexico.
Di event go last from June 11 to July 19 as di US go get 11 of di 16 venues.
Dem go get 104 matches wey go hold for 16 host cities wey include Toronto and Vancouver for Canada; Guadalajara, Mexico City and Monterrey for Mexico; and Atlanta, Boston, Dallas, Houston, Kansas City, Los Angeles, Miami, New York-New Jersey, Philadelphia, the San Francisco Bay Area and Seattle for di U.S.
Cristiano Ronaldo wey go be 41 wen di competition start don alreadi tok say dis go be im sixth and last World Cup and e go like end am wit winning di Cup for di first time for Portugal.
Nigeria go miss out on dia second back-to back world cup but kontris wey dey participate include defending champions Argentina (three-time World Cup winners), Brazil (record five-time winners), Germany (a four-time winner), France (two-time winners) and Uruguay (two-time winners) .
Europe total eclipse
Di first total solar eclipse for Europe in ova 20 years go happun for 12 August.
Di last time total eclipse bin happun for Europe na for March 2006. At dat time, parts of Russia and Turkey just go dark just like dat.
Di last time wey dat kain tin happun for di United Kingdom na back for 1999.
Astronauts around di Moon
NASA dey prep for dia crewed mission to fly around di Earth satelight and di long tme delayed Artemis II wey go dey scheduled to lift-off by April, bad as e bad.
Dis go be in line for America to get boots for di moon again.
Dis na sometim wey Trump don announce say na im goal since im first term in office.
America at 250
Di United States of America go celebrate dia 250th birthday from di day wen di kontri adopt Declaration of Independence for July 4, 1776.
Dem don alreadi start events ontop dis anniversary.
For New Year Day, America250, di team wey Congress arrange for 2016 to plan for dis anniversary go run float for di Rose Parade for Pasedena for California.
Di theme na "Soaring Onward Together for 250 Years."
Last year, Trump launch di executive order to plan events to mark di anniversary. Di events start from New Year Eve wit di Washington Monument go tun do "world biggest birthday candle" wit projections every night till January 5.
From 25 June to 10 July, Freedom 250 say a "Great American State Fair" go hold for di National Mall and go get pavillions from all 50 states.
Di group don also announce di first "Patriot Games" wey be four days athletic competition wey go take di top high school athletes, one boy and one girl from evri state and teritory.
Nigeria election primaries
Just bifor di kontri do dia national election for 2027, Nigerian political parties go run dia primaries to decided which candidates go run under dia party names.
For di ruling All Progressives Congress, fit be President Tinubu wey go run for second term in office. Dis na as campaign posters of im second term run don also start to dey run.
As per presidential cadidates wey run for 2023, Peter Obi don port from di Labour Party wey im use contest for di last election enta di new join-bodi opposition party wey be African Democratic Congress (ADC) for 31 December, 2025.
In all, Nigerians go sabi all di presidential candidates dis year 2026.
New Music expectations
From di foreign side, pipo like Bruno Mars don anounce say im album dey ready.
Di "Die With A Smile" artist bin reveal say "My album is done" for 5 January.
Di last time wey di artist bin drop new music na for 2024 wen e release collabo wit Lad Gaga, Rose and Sexxy Redd.
Apart from am, di biggest K-pop group for world, BTS dey come back togeda wit new album dis year afta dem split up for 2022 to fit go do dia military service.
Di seven member band announce say dia new album togeda go comot on 20th of March.
For Nigeira, Davido announce say e dey prepare to drop anoda album afta e end im tour for im 2025 album 5ive.