'My family dey disrespect my wife' - David Beckham son Peltz say im no wan settle wit im family

    • Author, Maia Davies
  • Read am in 6 mins

Brooklyn Peltz Beckham come outside for di first time to tok on top di tori about wetin dey happun between am and im parents. E tok say e no wan "reconcile" wit im family.

For series of posts for Instagram, di first born of David Beckham and Lady Beckham hala say im parents don dey "attack" im and im wife for press. E add say dem don dey try spoil im relationship wit Nicola Peltz Beckham,

For World Economic Forum panel on Tuesday, Sir David Beckham tok generally about social media say, e don try to "teach" im pikin dem about di positive sides and negative sides of social media, as im add say dem dey "allowed to make mistakes".

Di BBC don contact Sir David and Lady Beckham representatives for comment as di couple neva tok about di quarrel.

Brooklyn Beckham wey be 26 years write for series of post for im Instagram 16 million users say, "I don dey quiet for years and I don do evritin for my power to keep dis mata private".

"Unfortunately, my parents and dia team don continue to dey go press, so I no get choice but to speak for mysef, and tok true about some of di lies wey don dey printed.

"I no wan reconcile wit my family. I no dey controlled. I dey tanda for mysef for di first time for my life," e tok.

E add say, "recently I don see wit my own eyes di levels dem go go to, to place plenti lies for di media, mostly for di expense of innocent pipo to hide dia own face. But I believe di truth dey always come out."

Sir David bin dey snapped on Tuesday morning bifor e do podcast recording for di World Economic Forum for Davos, Switzerland but e neva gree to tok about di mata of wetin im first son write directly.

Sir David show for panel for Davos, Switzerland to tok about sport as business togeda wit di CEO and president of the Bank of America, Brian Moynihan.

Dis na as Sir David co-own Inter Miami CF and Salford City and also goodwill ambassador for Unicef. E tok say, "I don dey able to use my platform and following for Unicef and e don be di biggest tool to make pipo know wetin dey happun around di world as e concern pikin dem."

E add say, "I don try to do di same wit my pikin to teach dem, make dem make mistakes. Pikin dem dey allowed to make mistakes, na how dem dey take learn... but you sabi say you go need let dem make dose mistakes too."

Wetin Brooklyn Beckham tok say im parents do

Plenti of di younger Beckham statement focus on im relationship wit im wife, Nicola Peltz Beckham.

Nicola Peltz Beckham na American actress and also di pikin of billionaire businessman Nelson Peltz. And her husband don tok say she don dey "consistently disrespected by my family no mata how hard we don try to come togeda as one."

Brooklyn and Nicola wedding

E accuse im parents say dem try scata dia wedding as im claim say im mama wey be fashion designer bin "cancel di making of Nicola dress for dying minute even though she bin dey veri excited to wear her design, wey force am to start to find new dress".

Tori bin comot dat time say Nicola, 31 bin no gree wear one of Lady Beckham design. She later tok The Times to clear di air say her mother-in-law find out say her atelier no go fit finish di dress on time. And na so she take quench di rumour say fight dey ground.

E also accuse Lady Beckham say she hijack im and im wife first dance, say wen dem call am come stage, "na my mama bin dey wait to dance wit me" instead of im wife and she "bin dance very inappropriately on me for evribodi front".

E tok say dem bin renew dia vows for 2025 to create new memories "wey go bring us joy and happiness, not anxiety and embarrassment".

Brand 'Beckham' accusations

Brooklyn Peltz Beckham also accuse im parents say dem don "continue to pressure and try bribe am to sign away rights to im name" some weeks bifor di weddig. E neva clear di rights wey e dey tok about.

E tok say e no quick gree to do am wey "affect di payday and dem neva treat me di same since dat time".

Brooklyn don also call out im family say dem value "public promotion and endorsements pass any oda tin".

E write say "Brand Beckham na im dey come first" as e add say "wetin dey determine family 'love' na by how much you post for social media".

E tok say, "I don dey controlled by my parents for most of my life. I grow up wit overwhelming anxiety. Dis na di first time for my life, since I shift from my family wey dat anxiety don disappear".

Why Brooklyn and im wife no show for Sir David birthday

E also torchlight anoda mata wey ginger di tori say di family dey fight. Dat na as di couple no show face for di 50th birthday of Sir David for May.

Brooklyn Peltz Beckham say im and im wife bin travel go London for di birthday but dem bin dey "rejected for a week as we bin dey wait for our hotel room dey try plan quality time wit am".

Di influencer write say, "e refuse all our attempts, unless e dey for im big birthday party wit hundred guests and camera evriwia".

E tok say im papa "finally gree" meet am but under di condition say im wife no go dey, somtin wey im describe as "slap on di face". E also add say im family no gree see am even wen dem enta Los Angeles for visit.

Dat time one source bin tell BBC say di 26-year-old no greee go one party becos im younger brother, Romeo bin dey attend wit one woman wey e bin dey linked wit.

Family attacks from different angles accuse

Brooklyn Peltz Beckham post accuse im mama say she don dey "bring women from im past to im life ova and ova again in ways wey bin dey clear say na to make us uncomfortable".

E say e don face "endless attacks from my parents, both privately and publicly wey bin dey sent to tori pipo based on dia orders".

E add say im younger brothers bin also dey "sent to attack me for social media bifor las-las dem block me out of nowhere for di last summer wey just pass so".

But Cruz Beckham, 20 tok different tin. In responce to one Daily Mail tori, e say dia parents "no fit eva unfollow dia pikin".

E bin write for Instagram say, "No be true, My mama and papa no go eva unfollow dia son. Make we get am right. Dem two wake up see say dem dey blocked, me sef follow for di blocking".

Di former England football captain, Sir David and di former Spice Girl, Lady Beckham get two oda boys and one girl apart from Brooklyn. Dem be Romeo, 23, Cruz, 20, and Harper Seven, 14.