'My family dey disrespect my wife' - David Beckham son Peltz say im no wan settle wit im family

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Maia Davies
- Read am in 8 mins
Brooklyn Peltz Beckham come outside for di first time to tok on top di tori about wetin dey happun between am and im parents. E tok say e no wan "reconcile" wit im family.
For series of posts for Instagram, di first born of David Beckham and Lady Beckham hala say im parents don dey "attack" im and im wife for press. E add say dem don dey try spoil im relationship wit Nicola Peltz Beckham,
For World Economic Forum panel on Tuesday, Sir David Beckham tok generally about social media say, e don try to "teach" im pikin dem about di positive sides and negative sides of social media, as im add say dem dey "allowed to make mistakes".
Di BBC don contact Sir David and Lady Beckham representatives for comment as di couple neva tok about di quarrel.
Brooklyn Beckham wey be 26 years write for series of post for im Instagram 16 million users say, "I don dey quiet for years and I don do evritin for my power to keep dis mata private".
"Unfortunately, my parents and dia team don continue to dey go press, so I no get choice but to speak for mysef, and tok true about some of di lies wey don dey printed.
"I no wan reconcile wit my family. I no dey controlled. I dey tanda for mysef for di first time for my life," e tok.
E add say, "recently I don see wit my own eyes di levels dem go go to, to place plenti lies for di media, mostly for di expense of innocent pipo to hide dia own face. But I believe di truth dey always come out."
Sir David bin dey snapped on Tuesday morning bifor e do podcast recording for di World Economic Forum for Davos, Switzerland but e neva gree to tok about di mata of wetin im first son write directly.
Sir David show for panel for Davos, Switzerland to tok about sport as business togeda wit di CEO and president of the Bank of America, Brian Moynihan.
Dis na as Sir David co-own Inter Miami CF and Salford City and also goodwill ambassador for Unicef. E tok say, "I don dey able to use my platform and following for Unicef and e don be di biggest tool to make pipo know wetin dey happun around di world as e concern pikin dem."
E add say, "I don try to do di same wit my pikin to teach dem, make dem make mistakes. Pikin dem dey allowed to make mistakes, na how dem dey take learn... but you sabi say you go need let dem make dose mistakes too."

Wia dis foto come from, Reuters
Wetin Brooklyn Beckham tok say im parents do
Plenti of di younger Beckham statement focus on im relationship wit im wife, Nicola Peltz Beckham.
Nicola Peltz Beckham na American actress and also di pikin of billionaire businessman Nelson Peltz. And her husband don tok say she don dey "consistently disrespected by my family no mata how hard we don try to come togeda as one."
Brooklyn and Nicola wedding
E accuse im parents say dem try scata dia wedding as im claim say im mama wey be fashion designer bin "cancel di making of Nicola dress for dying minute even though she bin dey veri excited to wear her design, wey force am to start to find new dress".
Tori bin comot dat time say Nicola, 31 bin no gree wear one of Lady Beckham design. She later tok The Times to clear di air say her mother-in-law find out say her atelier no go fit finish di dress on time. And na so she take quench di rumour say fight dey ground.
E also accuse Lady Beckham say she hijack im and im wife first dance, say wen dem call am come stage, "na my mama bin dey wait to dance wit me" instead of im wife and she "bin dance very inappropriately on me for evribodi front".
E tok say dem bin renew dia vows for 2025 to create new memories "wey go bring us joy and happiness, not anxiety and embarrassment".
Brand 'Beckham' accusations
Brooklyn Peltz Beckham also accuse im parents say dem don "continue to pressure and try bribe am to sign away rights to im name" some weeks bifor di weddig. E neva clear di rights wey e dey tok about.
E tok say e no quick gree to do am wey "affect di payday and dem neva treat me di same since dat time".
Brooklyn don also call out im family say dem value "public promotion and endorsements pass any oda tin".
E write say "Brand Beckham na im dey come first" as e add say "wetin dey determine family 'love' na by how much you post for social media".
E tok say, "I don dey controlled by my parents for most of my life. I grow up wit overwhelming anxiety. Dis na di first time for my life, since I shift from my family wey dat anxiety don disappear".

Wia dis foto come from, Getty Images
Why Brooklyn and im wife no show for Sir David birthday
E also torchlight anoda mata wey ginger di tori say di family dey fight. Dat na as di couple no show face for di 50th birthday of Sir David for May.
Brooklyn Peltz Beckham say im and im wife bin travel go London for di birthday but dem bin dey "rejected for a week as we bin dey wait for our hotel room dey try plan quality time wit am".
Di influencer write say, "e refuse all our attempts, unless e dey for im big birthday party wit hundred guests and camera evriwia".
E tok say im papa "finally gree" meet am but under di condition say im wife no go dey, somtin wey im describe as "slap on di face". E also add say im family no gree see am even wen dem enta Los Angeles for visit.
Dat time one source bin tell BBC say di 26-year-old no greee go one party becos im younger brother, Romeo bin dey attend wit one woman wey e bin dey linked wit.
Family attacks from different angles accuse
Brooklyn Peltz Beckham post accuse im mama say she don dey "bring women from im past to im life ova and ova again in ways wey bin dey clear say na to make us uncomfortable".
E say e don face "endless attacks from my parents, both privately and publicly wey bin dey sent to tori pipo based on dia orders".
E add say im younger brothers bin also dey "sent to attack me for social media bifor las-las dem block me out of nowhere for di last summer wey just pass so".
But Cruz Beckham, 20 tok different tin. In responce to one Daily Mail tori, e say dia parents "no fit eva unfollow dia pikin".
E bin write for Instagram say, "No be true, My mama and papa no go eva unfollow dia son. Make we get am right. Dem two wake up see say dem dey blocked, me sef follow for di blocking".
Di former England football captain, Sir David and di former Spice Girl, Lady Beckham get two oda boys and one girl apart from Brooklyn. Dem be Romeo, 23, Cruz, 20, and Harper Seven, 14.
Who be Nicola Peltz Beckham?
"Actor. Writer. Director. And dog activist." Na wetin Nicola Peltz Beckham call hersef for her Instagram.
Even though na Beckham family gbas-gbos na im make she dey evribodi mouth now, on a normal dey she dey known for her acting career and her popular parents wey be billionaire businessman Nelson Peltz and model Claudia Heffner.
Her papa na founding member of one investment management fund for New York and bin work bifor as director of plenti global brands, one of dem na Heinz.
Her mama na successful model from di 1980s and 1990s and di couple born eight pikin for dia ova 40 years of marriage.
She bin start her acting for stage for 2005 for di Manhattan Theatre Club.
But she start to dey act for feem for 2004 as she act as Mackenzie for di Christmas feem Deck di Halls.
She bin also act for M. Night Shyamalan The Last Airbender for 2010 and for di 2013 series, Bates motel as well as Transformers: Age of Extinction (2014) and Hulu drama When the Street Lights Go On (2017).
Nicola don also show for music videos like for di song Its you by Zayn Malik and 7 Things by Miley Cyrus. She don also do modelling for brands like Genny.
She start to do director work for di 2024 feem Lola wey she bin also write and act inside. Di feem na about one girl wey dey try comot di broda from toxic family.
Di feem get mixed review as The Guardian comment say e dey "exploit hardship".
She don also tok about her privileged life say pipo don call am out say she no dey work and say she no blame dem sake of say she no show workings.
Apart from her work, Nicola dey popular on top di way wey she dey ginger her followers to adopt or foster animals wey cause Peta to give am award say she be Pawsome Adoption Advocate for 2022.
Na dat same 2022 she and Brooklyn run dia lavish wedding wey make pipo begin torchlight her.
Her husband, for interview wit Glamour torchlight say e bin meet her for Coachella but na afta one Halloween party dem start to collabo.
Nicola by hersef don dey hype up di Beckham family tay-tay.
For interview wey she do wit Brydie for 2024, she bin tok say, "family na evritin to me and I mean am wit my whole heart. I dey veri close wit my family and Beckham family and I tink no feeling beta pass to sabi say you get strong support system. Na blessing and I no go take am for granted".
Even though she still dey hail di family, tori be say she recently comot post wey hail Victoria Beckham for her 50th birthday.










