Authorities move to punish workers wey dey sleep ontop grave

Wia dis foto come from, Getty Images
One municipality for South Africa say dem go charge dia staff members for misconduct afta pictures show for social media wia dem sit and sleep on top graves.
Di workers na from di municipal parks department – wey dey responsible for di cleaning of parks and public facilities, according to local tori pipo.
E neva clear wen dem take di pictures.
For statement, Msunduzi municipality, for Kwa-Zulu Natal province, tok say dem no dey aware of di incident wey dem term as “disturbing fotos”.
Dem add say di city manager Lulamile Mapholoba don order investigation into di mata.
"Di municipality no go allow such behaviour and fit confam say di processes dey in place for di employees wey dey involve to dey charged for misconduct and say dem put di municipality for shame," di statement tok.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
'Pipo hold graveyards and tombstones for very high regard'

Wia dis foto come from, Msunduzi Municipality/Twitter
Di municipality further tok say pipo hold graveyards and tombstones on very high regard.
Some see am as spiritual places wia dem honour dia loved ones’ memories, and images of pipo wey dey siddon and sleep on dem be sign of disrespect, dem add.
End of Di one wey oda users dey read well well
Local tori pipo IOL bin report say no be di first time dem dey catch workers from di KZN capital for some kind embarrassing position.
Previous fotos don show workers from di same department dey sleep during di day, while some dey cook food during working hours.
Di mata raise concerns about dia productivity.











