Five takeaways from di leaked US top military chat group

US President Donald Trump (CR) and NATO Secretary General Mark Rutte (CL) wit US Vice President JD Vance (3R) and US Secretary of Defense Pete Hegseth (2R) during dia meeting for di Oval Office of di White House for Washington, DC, USA, 13 March 2025.

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Trump and im top aids don consistently raise concerns about footing di bill for European defence
    • Author, Paulin Kola
    • Role, BBC News
  • Read am in 6 mins

Washington DC still dey shake from one security breach wey happun for di heart of Trump administration.

Na di tori of how dem add one journalist - di Atlantic magazine Jeffrey Goldberg – to one Signal platform messaging group, wey include di Vice-President JD Vance and Defence Secretary Pete Hegseth, di National Security Adviser Mike Waltz also dey di group chat.

Di topic dem bin dey discuss na di attack on Iran-backed Houthi group for Yemen.

Goldberg tok say im see classified military plans for di strikes, wey include weapons packages, targets and timing, two hours bifor di bombs strike.

Wetin be di koko of dis informate?

Vance question di way Trump dey think

On di military action, Goldberg report say di account wey di name na JD Vance write say: "I think we dey make mistake."

Di vice-president tok say targeting Houthi forces wey dey attack vessels for di Suez Canal go serve European interests pass di US, bicos Europe get more trade wey dey pass through di canal.

Vance add say im boss fit no know how US action fit help Europe.

"I no dey sure di president sabi how inconsistent dis go be wit im message on Europe right now," Vance tok. "More risk dey as we fit see moderate to severe spike in oil prices."

Di vice-president bin add, according to Goldberg, say im go support di consensus but go prefer to delay am by a month.

Blame for 'free-loading' Europe

Arguments on top why di US fit - and suppose - carry out di military strike against di Houthis no move Vance.

E tell di defence secretary say, "If you think say make we do am, make we do am. I just hate to dey bail Europe out again."

Hegseth follow tok say:

"I fully share for your hatred of European free-loading. E dey PATHETIC."

One group member, wey only identify as "SM" bin suggest say afta di strike, make di US "make am clear to Egypt and Europe wetin dem dey expect in return".

"If Europe no pay, den wetin?" e ask.

"If US successfully restore freedom of navigation at great cost, den e get some more economic gain dem must benefit in return," di user continue.

Afta di strike: Emojis and prayers

Screenshot of di text messages, wey show emojis of a fist pump, American flag and flame.

According to Goldberg, di US national security chief post three emojis afta di strike: "a fist, an American flag, and fire".

Di Middle East special envoy, Steve Witkoff, respond wit five emojis, Goldberg tok: "two hands-praying, one flexed bicep, and two American flags".

Secretary of State Marco Rubio and White House chief of staff Susie Wiles bin voice messages of support, e tok.

"I go say a prayer for victory," Vance tok as dem give updates on di strikes.

Two oda members bin add prayer emojis, Goldberg report.

Di National Security Advisor Mike Waltz bin allegedly provide di update for di group chat, minutes afta explosions rock Yemen on 15 March.

Di US strikes bin kill 53, including five children, according to di Houthi rebels.

President Donald Trump bin label di action as "decisive and powerful", as e blame di Houthi attacks on shipping for di Red Sea as di cause.

Di group for Yemen capital Sanaa report di explosions, and dem say anoda one happun for di northern province of Saada.

Strikes bin continue ova di weekend, and Houthi leader Abdul Malik al-Houthi say im militants go target US ships for di Red Sea as long as di US continue to attack Yemen.

Controlling di message: Blame Biden

To Vance concerns say di action fit dey seen as going against Trump message on Europe, di US defence secretary write:

"VP: I understand your concerns – and fully support say you raise w/ POTUS [Trump]. Important considerations, most of which dey tough to know how dem play out (economy, Ukraine peace, Gaza, etc).

"I tink messaging go dey tough no matter what – nobody know who di Houthis be – which na why we gatz need to stay focused on: 1) Biden failed & 2) Iran funded."

Di Trump administration don consistently blame Joe Biden say e too dey lenient wit Iran.

Waltz for di spotlight

Goldberg say im bin get one invitation wey im no ask for on di Signal messaging platform on 11 March by one account wey di name na Michael Waltz, and dem add am to di group chat about Yemen two days later.

Di president no dey part of di group, but Trump closest collaborators dey part of am.

Goldberg bin first tink say na prank, but soon e see say na real.

Di whole issue dey add pressure on di national security adviser, as Democrats for di House and Senate dey call for urgent inquiry.

Wen dem ask President Trump on Monday about di whole incident, e say im no know anything, but e stand wit Waltz.

Di defence secretary also say dem no spill any secret.

"Nobody dey text about war plans," e tell tori pipo.

Wetin we call dis Video, Watch: President Trump say e no know 'nothing' about journalist inside Houthi strike group chat

Intelligence officials go appear bifor senate on chat breach

Di leaders of US intelligence groups go testify on Tuesday for one Senate hearing on worldwide threats wey dey face di kontri.

Starting at 10:00 EST (14:00 GMT), dem go hear testimony from:

Director of National Intelligence Tulsi Gabbard

CIA director John Ratcliffe

FBI director Kash Patel

National Security Agency director Timothy Haugh

Defence Intelligence Agency director Jeffrey Kruse

Signal: Wetin e be, who get am and e dey secure?

Signal, di app wey dem use discuss war plans don dey middle of di conversation since di tori of di leaked chat break.

Signal na one free messaging app, but no dey surprised if you never hear about am. E no dey popular like WhatsApp and Messenger, wey dey boast of billions of users.

Signal, get an estimated 40-70 million monthly users, wey dey use am primarily for di advanced security features di platform take different imsef.

Signal dey collect only small important info from users, and perhaps more importantly, dem no dey run am for profit like im oda rivals.

Na di Signal Foundation, one US-based non-profit organisation get am, and na through donations dem dey take make money instead of through advertisements wey fit track users.

All dis one mean say cybersecurity experts and journalists see Signal as special app - but e only dey as secured as di device e dey inside and di pesin wey dey use am. If pesin gain access to your phone and di Signal app dey open - or if dem sabi your password – dem go fit see your messages.

For dat reason, no messaging app fit take di place of secure government channels.