Feem about Prophet Muhammad daughter cause protest for UK

CineWorld

Wia dis foto come from, Getty Images

Cineworld don cancel all UK screenings of one feem about di daughter of di Prophet Muhammad, afta e cause protests outside some cinemas. 

Di cinema chain say dem make di decision "to ensure di safety of our staff and customers".

More dan 120,000 pipo na im sign petition for UK cinemas to pull down The Lady of Heaven film.

Di Bolton Council of Mosques say di feem dey "blasphemous" and e dey about a particular belief. 

Di feem don spark protests for Bolton, Birmingham and Sheffield.

Why di feem dey cause kasala?

Di feem, wey dem release for di UK cinemas on 3 June, bin claim to tell di tori of Lady Fatima, di daughter of Prophet Muhammad.

Some groups criticise am say di feem dey show Prophet Muhammad, in a way wey dey insulting in Islam.

Criticism mainly centre around di way di Shia Muslim film-maker and cleric Yasser Al-Habib don portray prominent revered figures for early Sunni Islam, dey show say e get comparisons between dia actions wit those of di Islamic State group for Iraq.

Leaders of di protests don tok say while dem want make dem ban di feem, dia demonstrations dey peaceful, but cinemas clearly feel dia behaviour dey intimidating enough to make dem stop di screening. 

Di feem website say "no individual represent any Holy Personality", wit dia performances instead dem achieve am "through a unique synthesis of actors, in-camera effects, lighting and visual effects". 

Meanwhile, di Muslim Council of Britain, di UK largest Muslim umbrella organisation, don describe di feem as "divisive".

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

For one statement on Sunday, di organisation say e "support those scholars and leaders wey dey advocate for greater unity and for di common good". 

"E get some - including many of dis feem supporters or those wey dey engage in sectarianism for di response – wey dia primary goal na to fuel hatred," di statement add. 

Screenings of di feem bin dey scheduled for Wednesday for a number of Vue cinemas for London and south-east England. 

For one statement, one tok-tok pesin say: "Vue take seriously di responsibilities wey come wit providing a platform for a wide variety of content and believe in showcasing feems of interest to diverse communities across di UK.

One tok-tok pesin for Cineworld say: "Due to recent incidents related to screenings of The Lady of Heaven, dem don make di decision to cancel upcoming screenings of di feem nationwide to ensure di safety of dia staff and customers."