Who be di ministerial nominee wey faint?

Balarabe Abbas Lawal

Wia dis foto come from, Kaduna State Government/Facebook

Di ministerial nominee from Kaduna State, Balarabe Abbas Lawal collapse during im screening before di Nigerian senate.

Di incident wey throw di senate into panic happun on Wednesday inside di red chamber.

Di senate immediately suspend dia sitting and enta closed door session as di incident happun.

“Get di doctor and all camera’s should be switched off,” na so Senate president Godswill Akpabio tok as di incident dey happun.

For di video wey dey circulate pesin fit also hear di senate president dey tok say make dem give di collapsed nominee “water and sugar”.

Di screening of oga Balarebe Abbas happun just as di senate dey also screen Dr Jamila Bio, and Ayodele Olawale Olawande – wey make up di new set of ministerial nominees wey president Bola Tinubu appoint.

Oga Lawal na di former Secretary to Kaduna State goment.

E suppose continue wit dat particular appointment under govnor Uba Sani administration until im get im nomination to become Minister.

Meanwhile di Senate don confam im nomination into di Ministerial candidate.

Senate President Godswill Akpabio announce am for di plenary say, "Di nomination of Balarabe Abbass wey dey represent Kaduna state dey hereby confirmed as Minister of di Federal republic of Nigeria".

Who be Balarabe Abbas Lawal

Dem born Balarabe for February 5, 1958 for Zaria, Kaduna State.

For 1971, e enta Barewa College wia tori be say e meet di former govnor of Kaduna State, Nasir El-Rufai.

E graduate from di Ahmadu Bello University for Zaria ten years later wit degree in political science. E later get in masters for di same Political Science from ABU.

E don dey work wit di goment since 1999 under several portforlio.

E don work wit goment as;

  • Special Assistant to di Minister of State for Education
  • Minister of State for Army of di Ministry of Defence
  • Special Assistant to di President, FCT
  • Chief of Staff to di Minister of di Federal Captital Territory
  • For 2015, Nasir El-Rufai appoint am as Secretary to di State goment of Kaduna, wia e dey till dis year.