Why tribunal sack Nasarawa govnor Sule, declare PDP Ombugadu winner of govnorship election

Wia dis foto come from, Sule/David/Facebook
Di Nasarawa state govnorship election petition tribunal don nullify di election of oga Abdullahi Sule as govnor of Nasarawa state.
Di three man panel declare David Ombugadu of di Peoples Democratic Party (PDP) as winner of di election.
Justice Ezekiel Ajayi, wey be di lead judge of di tribunal declare Emmanuel Ombugadu of di PDP as di lawfully elected govnor of Nasarawa State.
Two out of di three justices of di panel declare David Umbugadu as di winner of di 2023 Nasarawa State governorship elections.
Di PDP governorship candidate bin go court wia e claim say dem reduce im votes during di election for Nasarawa state.
E tell di tribunal say dem come increase di votes of di governor especially for Gayam and Chiroma Wards of Lafia Local Government Area.
However, di tribunal gree say PDP and dia candidate prove dia petition well.
Di court diafore say make di Independent National Electoral Commission (Inec) carry certificate of return give David Ombugadu as di right pesin wey win di election.
End of Di one wey oda users dey read well well
Counsel to di petitioner David Umbugadu, pf di Peoples Democratic Party, Johnson Usman explain wetin di judgement mean.
"Di PDP and e candidate of di Peoples Democratic Party Umbugadu approach di tribunal on di ground say Ahmed Sule no win di election by majority of l awful votes.
Rather, Umugado na im win di election afta e secure majority of lawful votes cast.
Dem raise all objections against di petition but court resolve dem in favour of di petitioners.
And di tribunal reach an irresistible conclusion wey say, based on di polling units results wia election and collation hold successfully, but dem record am wrongly for di ward results Form EC8B.
Wen dem look all di results from di polling units no doubt say Emmanuel Umugado win di election by di majority of lawful votes cast and di tribunal declare am."














