Presidential court dismiss petitions of Obi, Atiku & APM for lack of merit

All eyes dey di court of appeal as di presidential candidates of di PDP, LP and APM go know dia fate for di 2023 elections.

Live Coverage

Helen Oyibo, Victor Ezeama and Tamara Ebiwei

  1. All five Judges of presidential court unanimously uphold election of Bola Tinubu as president of Nigeria

  2. Una bye-bye

    We thank ou for staying wit us since morning.

    Na here we go gbab break for our coverage of di presidential election petition tribunal judgement.

  3. Breaking, PEPT dismiss petitions of Obi, Atiku & APM for lack of merit

    President Bola Tinubu

    Wia dis foto come from, Presidency

    Court don dismiss all di petitions of di three petitioners - Peter Obi of Labour Party, Atiku Abubakar of Peoples Democratic Party and di petition of Allied Peoples Movement.

    Lead Judge, Justice Haruna Tsamani announce di dismissal of di three petitions wey dem join togeda sake of lack of merit and say dem no prove dia allegations beyond reasonable doubt.

  4. Non compliance issue: Court troway witnesses statement

    On di issue of non compliance court say di Atiku no call any polling unit agent as witnesses, and na dem wey sign di result sheets.

    Instead dem call collation centre agents for State and National levels, dia testimony dey based on ‘hearsay’ sake of say no be dem witness am first hand.

    One of di witnesses visit only 20 polling units out of over 3,000 polling units.

    Most of di witnesses na collation agents and Section 43 of di Electoral Act 2022 say political parties suppose dey represented by polling unit agents wey witness any non compliance issue or alleged mago-mago by demsefs to testify.

    Out of di 27 witnesses wey Atiku and PDP bring, 10 na polling unit presiding officers.

    Court finally resolve di issue of non-compliance against di petitioner.

  5. Atiku no mention places wia dem allege say mago-mago happun

    Court say di Presidential candidate of PDP Atiku Abubakar no mention di name pf places wia dem allege ballot box snatching, di way dem snatch di boxes and di how dem manipulate di Bvas machines.

    E no also mention di polling units wia dem manipulate results and allege say mago-mago happun.

    Court aslo say di petitioner wey claim say im get majority of lawful votes, no tok in clear terms, di total lawful votes wey im claim to get.

    Court hold say Atiku allege say Tinubu no score majority of lawful votes but im no make di lawful votes known for im petition.

    Tribunal say Atiku make serious allegations against Kogi State governor, Yahaya Bello and Chairman of Olamaboro Local Goment Area of Kogi state Friday Adejoh but im neglect to join all dis pipo as respondents for di petition.

    Court hold say failure to join di govnor wey im bin accuse of electoral mago-mago don already kill di petition becos dem deny di govnor opportunity to defend imsef wey dey required by law.

  6. Live from inside di Court of Appeal

  7. Breaking, Tribunal troway Atiku petition wey claim say Tinubu na citizen of Guinea

    President Bola Tinubu and Atiku Abubakar

    Wia dis foto come from, AF/BBC

    Di presidential election petition court don strike out some parts of Atiku Abubakar and PDP petition.

    Some of di petition wey dem don strike out na di issues wey claim say Bola Tinubu get dual citizenship.

    Di court also strike out some portions of di reply wey Atiku Abubakar and di Peoples Democratic Party (PDP) file.

    Court stike out evidence of some witnesses say dem no file dia written statements along wit di petition.

    Court also say most of di witnesses wey Atiku Abubakar bring wey give dia testimony no get any bases to testify sake of say dem don already strike out all di issues wey di testimonies suppose stand on.

  8. Aisha Yesufu react to Tribunal Judgment on Labour Party case

    Human Rights Activist

    Wia dis foto come from, AISHA YESUFU/TWITTER

    One popular Labour party supporter don react to Appeal court judgement wey troway dia case for di Presidential petition tribunal.

    Di presidential election petition court for Abuja troway di case wey Peter Obi of Labour Party file to challenge di election of President Bola Tinubu.

    Haruna Tsammani, wey lead di five-member bench, say Obi case no hold water.

    Afta di judgement, Aisha Yesufu tweet say ‘Interesting how di constitution na living document wen e get to do wit 25%.

    ‘’But e no be living document wen e get to do wit forfeiture’’. she add.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

    Oga Tsammani say Obi fail to prove di allegations say Oga Tinubu no bin qualify to contest di presidential election.

    E rule say di $460,000 forfeiture order of one US court wey dem issue against Oga Tinubu wey gatz do wit drug trafficking case for 1993 no amount to a criminal conviction wey fit possibly lead to im disqualification from running for di presidency.

    Peter Obi no show face for court today.

  9. Judgement don start for Atiku Abubakar petition

    Atiku Abubakar na di presidential candidate of PDP
    Wetin we call dis foto, Atiku Abubakar, presidential candidate of PDP

    DI Presidential Election Petition Court no go on break afta dem give judgement on Peter Obi and Labour Party petition.

    Dem immediately start to give di judgement of Atiku Abubakar and im party di Peoples Democratic Party.

    Justice Moses Ugo dey read di lead judgement.

  10. Breaking, 'Evri tin for Peter Obi petition na just plenty tok' - Presidential court rule against LP & Obi,

    Di Presidential Election Petition Court don give judgement on Peter Obi wey be di presidential candidate of Labour party .

    Peter Obi bin raise four grounds of petition but di five man panel resolve all di four grounds against di LP candidate.

    Lead judge of di five-man panel Justice Haruna Tsammani describe oga Obi petition as "mere rhetorics"

    Peter Obi lose to Bola Tinubu
  11. 'Di word "and" dey completely fallacious' - PEPT tok

    Court don resolve di issue of 25 percent for di Federal Capital Tertory.

    About di 25 percent votes for di FCT, court rule say di word "and" dey completely fallacious.

    Court add say make dem no only give regard to technical rules as di constitution dey dia to guide generations to come.

    "Evri constitution get life and moving spirit. Di life and moving spirit of di Nigerian constitution dey for di preamble.

    Chapter 2 of di 1999 constitution focus on equality of rights and value of dia votes.

    E Indicate nothing more dan di desire for consistency.

    Di word 'and di FCT' no get di meaning wey di petitioners give am," Justice Haruna Tsamani tok.

  12. How Nigerians dey follow di Presidential election tribunal

    Nigerians dey monitor PEPC

    Nigerians dey monitor wetin dey happun for Court Appeal for television, radio and social media.

    For di most part of Wednesday major roads get free flow of trafic while busy places see some silence.

    Di Appeal court dey rule to decide di winner of di 25 February presidential election for di kontri on Wednesday.

    Na since morning dem don dey read di judgement wey dey live for television and social media streams.

    So far, di opposition parties - APM and Labour Party neva win any of di cases wey dem carry come di court dormot to challenge Bola Tinubu victory.

    Di five man panel of judges troway di opposition case of Kashim Shettima double nomination and di 25% of FCT votes mata.

  13. Breaking, Wetin don happun so far for di PEPT judgement on di 2023 presidential election

    Fotos from di presidential court

    Wia dis foto come from, Symfoni/Web

    Wetin we call dis foto, Fotos from di presidential court

    Di presidential court wey start since morning still dey deliver judgement on di 2023 presidential election.

    Di five man panel led by Justice Haruna Simon Tsammani start as early as 9am Nigerian time.

    Dem start wit di petition of di APM wey dem dismiss. Di panel don enta Peter Obi and Labour Party petition.

    Dis na highlights of di court ruling so far:

    • Tribunal dismiss di LP and Peter Obi petition ontop dia argument wey claim say iREV no upload real-time election results.
    • Di court rule say INEC dey at liberty to decide di mode wey dem go take transmit election results.
    • Di tribunal also dismiss petitions ontop di 25 per cent votes in FCT as dem rule say Abuja na like oda states.
    • Court reject 10 out of di 13 witnesses wey LP present.
    • Di tribunal say LP fail to prove di allegation of over-voting.
    • Tribunal resolve against di petitioners as dem fail to show case say any court bin charge, sentence or convict President Bola wey be di second respondent for drug issues.
    • Di issue of blurred results no hold water sake of say Labour party lie say dem bin no fit identify anytin for those polling units.
    • Di court declare APC petition wey challenge Peter Obi LP membership as incompetent sake of say na internal affair.
    • Court strike out di suit by Allied Peoples Movement (APM) wey argue say Vice President Kashim Shettima no dey qualified to contest
    Fotos from di presidential court

    Wia dis foto come from, Symfoni/Web

    Fotos from di presidential court

    Wia dis foto come from, Symfoni/Web

  14. Electronic transmission of results no dey provided for inside di Electoral Act

    Still on di electronic transmission of results issue, court say e no dey specifically stated inside di Electoral act 2022.

    Court add say na Inec introduce am for dia regulations on di conduct of di elections.

    Inec only introduce am for dia regulations on di conduct of di elections 2022.

  15. 'Inec no dey bound to transmit results electronically’ - Court tok

    Di PEPT decide on di issue weda di petitioner prove di allegation of non-substantial compliance to di provision of di electoral act by virtue of non-transmission of results from polling units to di collation system or IReV.

    Court make reference to di judgement of di Federal high court on di transmission of results wia di court rule say e no dey possible for Inec to transmit results electronically.

    Based on dis ruling, e dey wrong for di petitioner to tok say Inec dey bound to transmit results electronically. Court give examples of similar rulings.

    Meanwhile under di provisions of di electoral act, e no dey compulsory for Inec to transmit results electronically, na so PEPT tok.

    Di tribunal hold di position of di respondents wey say Inec get power to make dia own rules.

    INEC BVAS Machine
  16. Live from inside di Court of Appeal

    Follow di proceeding live from inside di Court of Appeal here.

  17. Breaking, Petitioner fail to prove say any court convict Bola Tinubu - Court

    On di ground of di civil forfeiture case wey dem allege say Bola Tinubu forfeit 46,000 US dollars sake of narcotics (drugs), Court say civil forfeiture no require any criminal charge.

    On dis ground, di petitioners fail to show case say any court bin charge, sentence or convict President Bola wey be di second respondent.

    On dis issue court resolve against di petitioners also.

  18. Breaking, Election tribunal declare Natasha Akpoti winner of Kogi Central Senatorial election

    Tribunal declare PDP Natasha Akpoti winner of Kogi Central Senatorial Election

    Wia dis foto come from, Natasha Akpoti-Uduagan/Facebook

    Kogi State Election Petition Tribunal wey siddon for Lokoja don declare Natasha Akpoti-Uduagan as di winner of di February 25 Kogi Central Senatorial election.

    Di court nullify di victory of Sen. Abubakar Ohere as winner of di election and ask am to pay Akpoti-Uduaghan N500,000 for di cost of di petition.

    Di tribunal Chairman, Justice K.A. Orjiako wey read di unanimous judgement of di three-man panel, tok say Ohere inflate di result of nine polling units for Ajaokuta Local Government Area (LGA) and dem intentionally reduce dat of Natasha.

    Di court afta dem make proper correction, declare Natasha Akpoti-Uduagan of di Peoples Democratic Party (PDP) winner of di poll as she score 54,074 to defeat her closest rival (APC) Sadiku-Ohere wey get 51,291 votes.

    Natasha for her reaction tok say "we won".

    Skip Instagram post
    Allow Instagram content?

    Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of Instagram post

  19. Breaking, Court troway FCT 25% votes mata

    On di FCT 25 percent votes, and di report say FCT get special status, court say FCT no dey enjoy any special status and diafore dem discountenance dat mata.

  20. Breaking, Blurred results: Labour party lie - Court

    Di court don also tok concerning di mata of di over 18,000 blurred results wey Labour party bin highlight say dem to any polling units.

    Meanwhile, Labour party bin bring one witness wey carry reports from those same polling units come wey dey clear.

    So diafore, di issue of blurred results no hold water sake of say Labour party lie say dem bin no fit identify anytin for those polling units. Court tok.