Kasala spread for Sudan as explosions rock di capital

Wia dis foto come from, Maxar Technologies
Na so so reports of fierce clashes across Sudan as fighting between rival armed factions continue to dey spread.
Violence between di army and one paramilitary group wey dem call di Rapid Support Forces (RSF) continue overnight into im third day.
Nearly 100 pipo don die for clash, according to wetin one doctors' union tok, and one estimate put di number of pipo wey dey injured at 1,100.
Both sides dey claim to have control of key sites for di capital Khartoum, wia residents dey hide from explosions.
Earlier on Sunday, dem hold a temporary ceasefire to allow di pipo wey injure comot, although e no dey clear how strictly dem stick to am.
Doctors draw ears say di situation for hospitals inside Khartoum dey extremely difficult, and say di kasala dey stop both staff and medical supplies from reaching pipo wey get injuries.
Di kasala na part of one vicious power struggle within di kontri military leadership, wey dey escalate enta violence between rival factions.
Di two men for im centre disagree over how di kontri suppose transition to civilian rule. Generals dem don dey run Sudan since one coup overthrow di long-standing authoritarian president, Omar al-Bashir, for 2019.
End of Di one wey oda users dey read well well
On Sunday and early Monday, di RSF claim say dem dey occupy sites for di capital Khartoum wey include di presidential palace, and di adjoining city of Omdurman, as well as for di western region of Darfur plus Merowe Airport for di north of di kontri.
But some accounts indicate say di army don regain control of di airport, wit di military saying dem dey deal with "small pockets of rebels".
Di army bin previously denied say di RSF seize key sites for di capital, and witnesses tell Reuters news agency say e be like say di army dey make gains after blasting RSF bases with air strikes.
'We neva sleep for 24 hours'
Residents of Khartoum dey tok of fear and panic, and reported gunfire and explosions.
"We dey fear, we neva sleep for 24 hours sake of di noise and di house shaking," Huda, a Khartoum resident, tell di Reuters news agency. "We dey worry about running out of water and food, and medicine for my papa wey get diabetic."
Another Khartoum resident, Kholood Khair, tell di BBC say residents no dey sure of safety anywhere. "Dem don advise all civilians to stay for dia house, but no dey keep everyone safe."
Di fighting na between army units loyal to di de facto leader, Gen Abdel Fattah al-Burhan, and di RSF, one notorious paramilitary force wey Sudan deputy leader, Mohamed Hamdan Dagalo, better known as Hemedti commanded dey control.
Di major sticking points na ova di plans to incorporate di100,000-strong RSF into di army, and over who go den lead di new force.
Di brief pause for di fighting on Sunday follow complaints from doctors' unions say e dey difficult for medics and sick pipo to get to and from hospitals as di fight dey continue to rage.
One chorus of international voices don call for a permanent end to di violence.
Leading Arab states and the US also don urged a resumption of toktok wey dem aim go restore civilian goment, while di African Union don announce say dem dey send dia top diplomat, Moussa Faki Mahamat, to try to negotiate a ceasefire.
Egypt and South Sudan also don offer to mediate between di warring factions, according to one statement by di Egyptian presidency.














