Senegal ruling party candidate, Amadou Ba concede to opposition

Wia dis foto come from, AFP
Senegal ruling party candidate, Amadou Ba don accept defeat as e don congratulate im political opponent Diomaye Faye wey dem say win di Sunday presidential election.
For inside one press release, Oga Amadou Ba tok say
‘’In light of di results wey dem don share so far and as we dey await official results, I go like congratulate President-elect Bassirou Diakhar Diomaye Faye for im first round victory. ‘’
‘’I pray God give am di necessary energy and strength to lead our kontri.’’ E add.
President Mackey Sall don also congratulate Oga Faye and say na win for di pipo of Senegal.
Di kontri Constitutional Council neva officially announce di final results but celebrations bin dey happun across di kontri afta provisional results on television put Diomaye Faye for early lead.

Wia dis foto come from, Reuters
However official results been ever dey announced yet.
Millions take part for di peaceful vote on Sunday, afta three years of katakata and opposition protests against di incumbent, Macky Sall.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di ruling coalition choice, Amadou Ba, don deny say e lose.
E say e expect to contest a run-off vote to decide di winner. Dis one go dey required if no candidate get more dan 50% of d vote.
Di results wey dem dey announce na from local media wey dey tally di results dem post outside individual polling stations.
E no dey clear how many of di 15,633 polling stations dem don count so far. Official results dey expected by Tuesday.
Move around di map below to see di results wen dem begin announce am officially.
From unknown prisoner to Africa youngest democratically-elected president
As at one year ago, na only few pipo bin don hear about am, and now e dey set to become president.
Bassirou Diomaye Faye extraordinary rise for Senegalese politics wey catch many pipo by surprise.
E bin dey jail for months alongside im ally and kingmaker Ousmane Sonko, but suddenly dem dey released from prison di week before dipresidential election.
Now Mr Clean, dem nickname am, must start work on di sweeping reforms e promise.
"Methodical" and "modest" na words pipo dey often use describe di tax collector, wey celebrate im 44th birthday on Monday.
Oga Faye fondly remember im rural upbringing for Ndiaganiao, wia e say im dey always go every Sunday to work di land.
Im love and respect for village life dey matched by im deep distrust of Senegal elites and establishment politics.
"E no ever be minister before and e no be statesman, so critics dey question im lack of experience," analyst Alioune Tine tell BBC.
"But, from Faye point of view, di insiders wey don run di kontri since 1960 don make some terrible failures."
Fighting poverty, injustice and corruption dey top of Mr Faye agenda.
Wen e still dey work for di Treasury, e and Oga Sonko bin create one union taskforce to tackle graft.
Gas, oil, fishing and defence deals must all dey negotiated to better serve di Senegalese pipo, Oga Faye tok.
Senegal president-elect don tok say im go drop di much-criticised CFA franc currency, wey dey pegged to di euro and wey former colonial power France dey support.
Mr Faye wan replace am wit new Senegalese, or regional West African, currency, although dis no go dey easy.












