Arsenal vs Bournemouth: Gunners score last minute goal to win for Emirates stadium

Wia dis foto come from, Getty Images
Premier League leaders Arsenal beat Bournemouth 3-2 to maintain dia lead for di top of di table.
Di Gunners come from two goals down to win di match wey start well for di visitors.
Bournemouth take di lead for di match just afta 9.11 seconds wit goal from Philip Billing, and dem go 2-0 up wit Marco Senesi header.
But Arsenal no give up, dem continue to play dia game and e work for dem.
Na dia Ghana star Thomas Partey score dia first goal followed by Ben White, before Nelson strike.
Dis result mean say Arsenal still dey gap Manchester City wit five points for table.
For Bournemouth, dem still dey relegation zone for 19 position.
Arsenal next game na away to Fulham on March 12 while Bournemouth go jam Liverpool.
End of Di one wey oda users dey read well well

Wia dis foto come from, Getty Images
Second half
Full time- 3-2
90+9 mins- Chris Kavanagh, di referee look im watch and immediately end di match.
90+7 mins- 3 - 2
Arsenal Reiss Nelson collect cross from corner kick and strike di ball from di edge of the box. Di ball beat di goalkeeper and enta inside di right post.
90+5 mins- Arsenal Reiss Nelson dey unlucky with im goal-bound effort from di edge of di box. Neto stop di ball from entering inside di middle of di goal.
90+3 mins- Arsenal dey show great team work wit dia short pass and one-two pass, dem dey waiting to open di visitors defence to hit them quick.
90 mins- 6 min. of stoppage-time na di put for di match.
90 mins- Arsenal Granit Xhaka try to play low pass inside di box, but di visitors block and clear di ball.
87 mins- Di referee and one of im assistants signal for corner kick to Arsenal.
86 mins- Bournemouth Chris Mepham don chop yellow.
84 mins- Arsenal substitution, Mikel Arteta bring in Granit Xhaka and replace am wit Fabio Vieira.
82 mins- Anoda substitution for Bournemouth. Dango Ouattara go rest as and Ryan Christie go take im place.
81 mins- Arsenal players no believe say referee Chris Kavanagh signal NO PENALTY afta VAR review. Play don continue.
80 mins- Dis look like handball by one of di Bournemouth players inside di box, but direferee just wave play on!
75 mins- Arsenal Gabriel Martinelli try to shoot from inside di box but blazes but di shot go ova di bar.
74 mins- Arsenal Bukayo Saka miss great chance to score afta im shot hit di right post!
71 mins- Gary O'Neil wan make substitution. Lewis Cook don replace Joe Rothwell of Bournemouth.
70 mins- 2 - 2
Goal! Arsenal Ben White na im be di goal scorer.
63 mins- 1 - 2
Goal! Thomas Partey (Arsenal) pounce on a loose ball inside di box and beat di goalkeeper wit a low shot inside di middle of di net. To make am 1:2.
57 mins- 0 - 2
GOAL! corner kick find Bournemouth Marcos Senesi wey dey di right place at di right time, to head di ball for di middle of the goal. To make am 0:2.
57 mins- Bournemouth Joe Rothwell try to find di head of one of his teammates from corner kick.
56 mins- Arsenal Thomas Partey pull di shirt of im opponent and im escape without punishment from di referee.
54 mins- Arsenal Gabriel Martinelli fire hot shot, but e just fly over di bar. Di ball comot for field so na goal kick for Bournemouth.
52 mins- Arsenal Martin Odegaard shoot from di edge of the penalty area. Di ball travels low towards di middle of the target, but na easy save for Neto.
49 mins- Anoda corner for di home team but again no goal.
47 mins- Arsenal dey dominating di game now wit dia one or two touch passes.
46 mins - Mikel Arteta don make change for half time. Ben White don enta to replace Takehiro Tomiyasu.
First Half
Half time score- 0-1
45+4 mins- Chris Kavanagh, di referee don blow im whistle to end di first half.
45+3 mins- Arsenal Bukayo Saka attempt to find im teammate wit pass from outside di box, but di visitors defence react quick to stop di attack. Arsenal get corner kick.
45 mins- Na minimum of 3 min. of added time dem give for di match.
44 mins- Arsenal try anoda cross dis time na from Bukayo Saka but is still no worry di visitors.
42 mins- Arsenal Emile Smith Rowe shot no worry di goalkeeper.
41 mins- Arsenal Takehiro Tomiyasu cross no find any of im teammate inside di box.
39 mins- Bournemouth defence clear Arsenal corner kick.
38 mins- Bournemouth Dominic Solanke try to play counter, but e no work as Arsenal clear di ball.
35 mins- Afta VAR review di referee signal NO PENALTY to Arsenal, play continue.
34 mins- handball by one of Bournemouth players inside di box, but di referee just wave play on!
32 mins- Arsenal Bukayo Saka try short corner dis time instead of sending di ball inside di penalty area.
31 mins- Bournemouth defend Arsenal corner kick well.
29 mins- Arsenal Fabio Vieira Arsenal run towards goal but di defender recover quick to make a challenge.
24 mins- Arsenal Martin Odegaard shot from free kick go wide.
23 mins- Substitution for Arsenal Leandro Trossard don comot sake of injury. Mikel Arteta don bring in Emile Smith Rowe
21 mins- Bournemouth Dango Ouattara bin get great chance inside di six-yard box, to shoot to di right side of di goal, but Aaron Ramsdale deny am di opportunity.
18 mins- Martin Odegaard of Arsenal take dia free kick but di visitors clear di ball.
14 mins- Arsenal Gabriel Martinelli fine pass inside di box, but Neto sharpely intercept di ball.
12 mins- Chris Kavanagh di referee don blow im whistle for foul afta Arsenal Thomas Partey aggressive play wit di ball
10 mins- Arsenal Bukayo Saka cross ball inside di box, but Neto comes off im line to catch di ball.
8 mins- Arsenal dey play possession football, na dem dey control di game for now.
7 mins- Arsenal Leandro Trossard take corner kick, but one of di defenders reacts well and jump di highest to head di ball away.
4 min- Arsenal Martin Odegaard find space on di edge of the box and shot hot shot but goalkeeper save di ball
Gooal! Philip Billing for Bournemouth manages to put di ball inside di net.
1 min – Di match don start.
Arsenal vs Bournemouth prediction
Di Gunners dey fine form since dem lose Manchester City, dem don win all three of dia matches.
Not just winning alone dem dey play beautiful football na wetin Chris Sutton tok.
Bournemouth go ginger well-well and I no think say dem go be walkover, but Arsenal dey form and dia confidence high.
Mikel Arteta side go slip up again before di end of di season, no doubt about that... but no be dis Saturday.
Sutton prediction: 3-0










