BTS Star Jung Kook, odas totori fans for di 2022 Fifa World Cup opening ceremony

Jung Kook

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, BTS Jung Kook open di 2022 World Cup wit im World Cup song Dreamers

BTS star Jung Kook na im first perform for di opening ceremony of di 2022 Fifa World Cup for Qatar.

Di member of di South Korean boy band group perform di official World Cup song Dreamers as e thrill di audience for di Al Bayt stadium.

Jung Kook perform di official World Cup song Dreamers wit Qatari singer Fahad Al-Kubaisi. Thousands of fans sing and dance to di song wey Qatar use welcome 31 kontris come di World Cup. 

Di 25-year-old bin release di track for Fifa World Cup 2022 wey im title Dreamers on di opening day of di Qatar World Cup.

Di song highlight optimism wey every World Cup dey bring every four years. “Look who we be, we be di dreamers, we go make am happun cause we believe am,” na how di song take start.

World Cups dey always get landmark tracks like Wavin Flag and Waka Waka for 2010 to di Cup of Life for 1998 and dis track go be anoda addition to di collection.

Di World Cup opening ceremony take place on November 20, ahead of di opening Group A match between host Qatar and Ecuador.

Jung Kook

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, BTS Jung Kook open di 2022 World Cup wit im World Cup song Dreamers
Morgan Freeman

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Morgan Freeman perform during di opening ceremony before di Fifa World Cup Qatar 2022 Group A match between Qatar and Ecuador for Al Bayt Stadium

Di opening ceremony start proper wit Hollywood actor Morgan Freeman wey be di official narrator for di ceremony.

E tok about how di World Cup dey open to di whole world and about di "emotions wey connect us all now".

Pipo bin clap wen Sheikh Hamad bin Khalifa Al Thani show for one big screen.

Di sheikh na di man wey hold di World Cup trophy for Switzerland wen Qatar win di bid to hold di tournament for 2010.

Some Ardah dancers wit swords also perform for di opening ceremony. Some pipo wey no wear cloth also dey hit di drums.

Pipo dance wit all di World Cup flags.

Qatar 2022 mascot na giant wey dem call La'eeb - La’eeb, na Arabic word wey mean super-skilled player. E belong to one parallel mascot-verse wey dey indescribable.

La’eeb bin encourage everyone to believe in themselves.

Laeeb

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, One giant model of di mascot Laeeb during di opening ceremony of di Fifa World Cup Qatar 2022 Group A match between Qatar and Ecuador for Al Bayt Stadium
Morgan Freeman and Ghanim Al-Muftah

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Morgan Freeman and Ghanim Al-Muftah take part for di ceremony
Qatari singer Dana al-Fardan

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Qatari singer Dana al-Fardan perform early for di ceremony
Jung Kook and Fahad Al Kubaisi

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Jung Kook and Fahad Al Kubaisi perform Dreamers for di show
Di light show

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di light show during di opening ceremony
Pyrotechnics surround giant version of di World Cup trophy

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Pyrotechnics surround giant version of di World Cup trophy
La'eeb, di tournament mascot, float above di pitch during di ceremony

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, La'eeb, di tournament mascot, float above di pitch during di ceremony