'Fantastic Four' actor Julian McMahon don die

Wia dis foto come from, Reuters
- Author, Paulin Kola
- Role, BBC News
- Read am in 4 mins
Australian actor Julian McMahon, wey dey famous for im roles for popular series like Nip/Tuck and Charmed, don die at di age of 56.
Im wife say di actor bin pass away for Clearwater, Florida, on Wednesday. Dem bin diagnose am wit cancer.
"Julian love life. E love im family. E love im friends. E love im work, and e love im fans. Im deepest wish na to bring joy into as many lives as possible," Kelly Paniagua tok for statement carried by Deadline.
McMahon career take off wit di hit supernatural television series Charmed bifor e gain wider recognition wit Nip/Tuck, di medical drama wia e play di role of plastic surgeon Dr Christian Troy.
For tori on oda ogbonge actors, join Pidgin WhatsApp Channel.
Running for six seasons from 2003 to 2010, di show earn am a Golden Globe nomination.
Co-star Dylan Walsh tell Dealine say e dey "surprised". "We ride dis wave togeda and I love am.
"Jules! I know you go want make I tok somtin to make you smile—all di inside jokes. All dose years you dey my back, and my God, we laugh. My heart dey wit you. Rest in peace."
End of Di one wey oda users dey read well well
McMahon also play Doctor Doom for two Fantastic Four films for 2005 and 2007 and later appear for three seasons of FBI: Most Wanted.
Dick Wolf, di producer of FBI: Most Wanted, say McMahon death na "shocking news".
McMahon na di son of a former Australian prime minister and bin play Australian prime minister role for Netflix The Residence - one of im recent appearances.
McMahon marry three times - di first to Australian singer-actress Dannii Minogue, sister of Kylie Minogue.
About Julian McMahon
McMahon wey pipo sabi as Ben Lucini for im role in one television soap opera "Home and Away."
E also feature in US series Charmed and Profiler wia dem nominate am for Golden Globe award for best actor in small screen series for im work .
McMahon appear in di 2018 Australian comedy movie Swinging Safari and im recent work include "The Residence", wey show on Netflix earlier dis year, and Stan Original series "The Surfer."
McMahon bin marry singer Dannii Minogue in di 1990s afta dem meet on di set of Home and Away but dem divorce and e later marry actress Brooke Burns in 1999, and dem born one pikin togeda, Madison in 2000 bifor dem separate in 2001.
Dem born McMahon into wealthy family, im papa na Sir William "Billy" McMahon, a Liberal, former prime minister of Australia in 1971-1972.
And im mama, Lady Sonia McMahon, na popular heiress, socialite and fashion icon.
Lady Sonia McMahon born three pikin and McMahon na her second pikin wey she born for Sydney in 1968, bifor im papa become di Australian prime minister in 1971.
McMahon start im career as model in di 1980s bifor into moving into acting, e land di Australian soap Home and Away role in 1990 and e don appear in 150 episodes.
He don also feature film in di 1992 comedy "Exchange Lifeguards", titled "Wet and Wild Summer!" for US, alongside "Elliott Gould", and e quickly move into US television, wia e appear in "Another World, and Will & Grace" in di 2000's.
E gain wider recognition as di half-human, half-demon assassin Cole Turner in di hit supernatural series "Charmed", e appear on di show between 2000 and 2003 and return in 2005.













