True tori of how MohBad die - Police reveal five 'key suspects'

Wia dis foto come from, Collage From Instagram
Police say from dia investigations Mohbad die of reactions from medications wey di nurse wey treat am give am.
“Di auxiliary nurse wey treat Mohbad na di principal suspect’, di Commissioner of police say na wetin dem discover afta thorough investigation on di matter.
"Di nurse na just an auxillary nurse, she no get any job at di moment so she dey work from her house. She be quack by our standard," di CP add.
Commissioner of police, CP Idowu Owohunwa make di revelation wen e dey tok to tori pipo on Friday for di Lagos state police command.
E tok many tins including say officers visit Mohbad house wia dem wan go carry CCTV footage but di CCTV no dey work since before di incident happun.
Police say on di night of 10 September MohBad bin dey high afta im perform for one show for Ikorodu area of Lagos.
Na from di incident of dat night tins begin happun wey lead to di death of MohBad.
How di investigation go
Police say dem identify and interrogate a total of 26 important witnesses plus di pesin wey carry di complain go meet authorities.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di pipo wey dem interrogate and investigate include Mohbad papa, Mohbad mama, im sister and broda, im wife, im manager, im Personal Assistant, im DJ, photgraphers, im friends, di driver wey Mohbad hire im Prado Jeep to attend concert for Ikorodu and odas.
Police oga Owohunwa say true-true Mohbad get infection wey make am involve di auxiliary nurse wey give am some kain drugs wey make am react bifor e die.
"MohBad enta fight wit one of im friends afta e perform for one show for Ikorodu. As e wan punch di guy na im e punch di window of one Prado Jeep.
"E begin bleed from di injury wey dey also pain am. Dis na why e call im own nurse wey bin no dey available. To make sure say dem treat di wound im friend Spending come call im own nurse wey come treat MohBad."
Wetin really happun?
Mohbad bin attend one concert for Ikorodu wey Soso Soberekon invite am to perform to promote one drink.
Police say na from dat event fight happun wey Mohbad wound, wey come lead to all di events wey happun wey finally kill am.
Im attend di concert wit im wife and im five months old son. Mohbad enta di Prado Jeep wey e hire sake of di occassion while odas join wit oda cars.
Wen im perform finish, im discover say dem don block im car wen im wan go.
At dat time im bin dey high, Ibrahim stop am from coming down to claer di car saka of say im no dey in im right senses.
Oga Omoniyi Raphael aka Zlatan na one of di musicians wey perform for di event dat night. Engineer China Jesse na Mohbad neigbour wey dem use im motor rush Mohbad go hospital wen im bin dey unconscious.
Dr Orishola Joshua na di Medical Director of Curamed Hospital for Lekki, Lagos, Nigeria wia dem carry Mohbad go wen dem confam say im don already die on 12 September, 2023.
Dr Deborah Oluwatosin na di Medical Director wey bin dey on duty wey also certify di deceased dead on di day wey dem bring am at about 3.45pm for afternoon.
Some staff of di hospital also witness am wen dem bring Mohbad to di hospital dead.
Dr Iwuala Chigozie na di Director and CMD of Peres Medical care for Lekki.
“Wen dem carry am go di first hospital wey be Curamed and dem confam say im don die, im family members and friends wey carry am go dia no believe. So dem carry di body from dia go Peres Hospital wia dem also confam say im don die.
Dr Oluwatosin Olumuyiwa na di Director of Cornerstone Hospital, Akote, Ogun state, wia di ogbonge suspect Feyisayo Ogedengbe claim say dem train her as Auxilliary Nurse.
Wetin Police find out
Afta di investigation, police find out say na di auxilliary nurse wey Ayobami Sodiq aka Spending, wey be Mohbad friend invite on 11 September, 2023 to come treat am sake of di wound e get for hand for im house for Lekki lead to im death.
Na on Tuesday 12 September, 2023 she come and she give am three different injections wey dem believe say cause chain reactions for im body wey directly result to im death.
“Na she be di principal suspect for di death of Mohbad, she confam say na di reactions wey im get from di injections wey she give am na im lead to im death.
Oda expert opinions and statement from witnesses match wit wetin she tok.
She give Mohbad doses of Tetanus toxins, Paracetamol injection and Setrazone injection intravenously.
Dis immediately trigger reactions from Mohbad wey include vomiting, goose bumps and convulsion”
Police say as Auxillary nurse she no qualify go give dat kain medications and also get beta knowledge to function as a qualified nurse in a non-clinical environment. Dem see link of negligence from di nurse wey lead to Mohbad death.
Police say Sodiq Ayobami aka Spending wey be Mohbad friend wey also invite di nurse to treat am dey suspected of 'conspiracy' for di death of Mohbad.
"Im action to invite pesin wey im sabi as auxiliary nurse to treat Mohbad for place wey no be hospital, wey dey hold am for conspiracy to commit felony" police tok.
Police also find out say she no be just auxiliary nurse , she dey work from house and no get any work at di moment.
Police say dem visit di crime scene, wey be Mohbad house for Lekki and dem recover di following;
- Drugs wey remain and some test kits
- One Tetanus toxin injection.
- Three syringes wey dem don use
- Two use syringes wey unused medicine content dey inside.
- One packet of Setrazone solution.
- Procane Penicillin injection.
- Empty broke pack of Declofenac injection.
- Paracetamol wey dem dilute wit water.
- Injection water.
- Six handles, one bandage, one plaster and one Iodine solution.
Police say from dia investigations dem don establish say:
- "Di events wey cause Mohbad death happun between 10 to 12 September, 2023 and e happun between Ikorodu and Lekki, Lagos, Nigeria.
- Feyisayo Ogedengbe, wey be di auxiliary nurse give am plenti highly potent injections wey trigger reactions wey finally cause im death.
- She be di ogbonge suspect for dis homicide case. She no be qualified registered nurse, her illegal and medical negligence na im cause di chain reactions Mohbad get wey lead to im death.
- From di time wey di nurse give am di injections to wen im begin dey react and convulse to wen dem confam say im don die reach one hour.
- Di report from di medical panel aslo confam say di nurse do pass her power as she give am Setrazone injection from di vein and na dis tin from dia review wey cause di reaction, and di situation for dey prevented, Mohbad for no die like say dem treat am for hospital." police conclude.
Police say on 21 September, 2023 dem dig out Mohbad deadibody do toxicology tests and autopsy and dem still dey wait for di results.
Allegations of bullying by Naira Marley and Sam Larry
Police say dia investigations show say true-true Naira Marley and Sam Larry allegedly bully Mohbad and assault am many times wit dia gangs.
Police say dem also get video evidence wey match di statements of di witnesses say before Mohbad die im raise alarm say dem dey threaten im life.Police say afta dia interrogation Naira Marley and Sam Larry deny say dem get hand for Mohbad death.
Police say dem get evidence wey link Naira Marley and Sam Larry wit di allegations of threat to life, cyber stalking, and plenti crimes wey dem commit against Mohbad wen im dey alive and dem dey hold dem liable.













