Primeboy don surrender to police

Wia dis foto come from, Owodunni Ibrahim/Facebook
Owodunni Oluwatosin alias Primeboy don go show himself for police station afta police declare am wanted on Wednesday, 4 October.
Tok-tok pesin for di Lagos state police command Benjamin Hundeyin wey give dis informate tok say Primeboy dey dia custody now for interrogation plus oda necessary actions.
Na on Wednesday, police authority declare Primeboy wanted and dem offer one million naira reward for anybody wey go help dem wit im arrest.
Di authorities declare am wanted afta e fail to honour police invitation dem send to am since investigation into di death of Ilerioluwa Aloba wey many pipo sabi as Mohbad, di Nigerian singer start.
Mohbad die on 12 September and im death don spark controversies, concerns and calls for Justice for across di kontri.
However, police don give assurance say all di pipo wey get hand for di death of di music sensational star go face justice.
Dis article contain content wey Facebook provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Facebook cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Facebook post
Di Lagos State Police Command bin declare Owodunni Ibrahim alias Prime Boy wanted in connection wit di death of Mohbad.
Di police also announce one million naira bounty on im head for anyone wey get useful information wey go lead to im arrest.
End of Di one wey oda users dey read well well
Police tok-tok pesin, Benjamin Hundeyin for one statement tok say Primeboy dey wanted sake of im failure to honour police invitation as investigation into di death of Ilerioluwa Aloba dey go on.
“Ibrahim dey approximately 1.64-m tall, male, dark-complexioned, e get tribal marks and e be Yoruba by tribe. His last known address na 3rd Power Oke Eletu, Ikorodu.” Di statement tok.
Even before police declare am wanted, rumour don dey spread say Primeboy get hand for di death of di young star.
Primeboy also bin don address di rumour on im social media page. E clear am say im no get hand for Mohbad death as di singer na im childhood friend.
E also tok about dia last outing togeda wey some pipo allege say get something to do wit im death.

Wia dis foto come from, Collage From Instagram
“Nothing happun between me and my friend. Mohbad na my childhood friend, my close friend. I gain a lot from am, e dey give me free access to meet pipo foe di industry, why I go kill my friend my friend.?” E tok for di video e do for im Facebook page.
Primeboy add say on Mohbad last outing dem bin dey togeda.
“I and Mohbad bin dey on stage togeda and e don high well-well, we come down stage and we sit for im car togeda wit im wife, e insist say e wan dey go house as e no dey comfortable again, I tell am say make e relax make I go clear road for am,” E no end di statement finish.
Owodunni Ibrahim also na singer.

Wia dis foto come from, Lagos State Police
Naira Marley, Sam Larry go remain for police custody, Court rule
Lagos state police command on Wednesday charge Naira Marley and Sam Larry before one Magistrate court for Yaba, Lagos state.
Di court grant di police request to keep dem for custody for investigation.
Magistrate Adeola Olatunbosun rule say make police keep dem plus oda suspects wey dem dey investigation for di death of mohbad for dia custody for some days.
Di Lagos state police command confam say Naira Marley dey wit dem on Tuesday night.
Tok-tok pesin of di command SP Benjamin Hundeyin for im post on X say "Naira Marley don dey our custody for interrogation and oda investigation activities.”
MohBad die on 12 September at di age 27.
Di death of MohBad na one wey touch many Nigerians and spark a call for justice following reports wey allege say e suffer bullying, harassment and assault as a musician wey bin dey signed under di music label Marlian records.

Wia dis foto come from, Naira Marley/X

Wia dis foto come from, Benjamin Hundeyin/X
Tori be say Naira Marley wey be di owner of Marlian records enta Naija to help police for di investigation of Mohbad death.
Di record label owner, wey also be popular musician Naira Marley don deny all accuse say im get hand for Mohbad death.
For one statement wey im release earlier, Naira Marley tok say im also dey traumatised sake of di death of im former signee just like evri oda pesin dey traumatised.
Naira Marley tok say Mohbad bin leave di record label for September 2022 and add say di misunderstanding wey dem get no reach make dem wish di oda pesin death.













