Cancellation of Adani deal and oda key points from President Ruto state of di nation address

President Ruto speaking wit pink tie in front of a podium and two flags by di side

Wia dis foto come from, X/@WilliamsRuto

Read am in 5 mins

Di President of Kenya, William Ruto don cancel two major project deals wey involve di Indian Adani Group including oda matters wery affect Kenyans.

Dis deal cancellation dey come afta executives for di Adani company dey charged wit corruption by US prosecutors.

For im state of di nation address, President Ruto say make dem scrap di procurement process for di expansion of Nairobi main airport as well as a multi-million-dollar deal to construct power lines.

Kenya local media report say Adani bin propose a Ksh.260 billion deal to renovate di Jomo Kenyatta International Airport (JKIA) wey go spread ova 30-year period and also provide Ksh.95 billion to develop di transmission lines for di country.

Meanwhile, during di state of nation address, President Ruto say make di Kenya Ministry of Transport and Energy cancel di ongoing deal sake of informate wey reach dem.

"For di face of evidence or credible information on corruption, I no go hesitate to take action. Based on di new information wey investigating agencies and partnering nations provide, make di procuring agencies within Ministry of Transport and Energy immediately cancel di ongoing process for di JKIA PPP deal and KETRACO deal," Ruto tok.

Wetin do Guatam Adani

Indian billionaire Gautam Adani don dey charged with fraud for US, wey accuse am of master minding a $250m (£198m) bribery scheme and hiding am to raise money for US.

Dem file di criminal charges on Wednesday for New York and dis na di latest blow to 62-year-old Mr Adani wey be one of Asia richest men and im business empire include ports, airports to renewable energy.

For di case, prosecutors allege say di business tycoon and oda senior executives bin agree to di payments to Indian officials to win contracts for im renewable energy company wey dey expected to yield more dan $2billion profits for ova 20 years.

Although, di Adani Group don deny di allegations as dem refer to am as "baseless", but di company dey drop for market value afta di charges against dem.

Oda issues wey Ruto address

  • Job creation and employment

Among di plenti tins wey oga Ruto tok for im address na how im administration don provide job for di citizens of Kenya.

Di president say e don help some Kenyans get jobs for foreign countries and di housing program wey im administration introduce don help generate new jobs for di past one year.

"Oga Ruto tok say Kenya get a serious housing deficit and na why di affordable housing program na important component of di kain program wey im dey implement throughout di kontri.

"Government don successfully facilitated employment of 105,367 Kenyans for foreign kontri since July last year."

"As we dey speak, affordable housing don directly account for 164,000 new jobs wey we create ova di past one year," Ruto tok.

  • Food security and economy

Oga Ruto agree say many Kenyans dey struggle and dey wonder say wen dem go benefit from all di program wey di government dey implement.

But e tok say im administration don to turn tins around in di positive way and don also try to stabilise di economy and cost of living for Kenya.

"Di cost of living dey veri high wit prices of basic commodities beyond di reach of many households. Today I dey proud to report say di macroeconomic indicators dey point to a positive turnaround," Ruto tok for im address.

Although, e add say Kenya neva dey wia dem suppose dey as a country but no be wia dem dey bifor dem still dey - e mean say di country don improve for economy matter.

For di issue of food for di country, oga Ruto say e don dey make food available for plenti houses wit support for farmers.

Di president say e get 'approach to support production rather dan subsidize consumption' and dis don alreadi dey make 'food more affordable to many houses'.

"Di shilling don stabilize seriously, as e don go high from Ksh 162 for February 2024 to Ksh 129 today. Inflation don drop from 9.6% for September 2022 to 2.7% in October dis year, di lowest rate for 17 years," Ruto tok during im address.

  • Education

Since di major floods wey hit Kenya di last time, di education sector for di country don dey under serious monitoring and delay.

During dat time, di flood bin spoil plenti schools wey make dem suspend school and extend breaks.

Meanwhile, during di state of nation address, oga Ruto announce more support for education wey go help vulnerable students and go offer "dem up to 95% government support".

Ruto say e don introduce good transition to prevent di kain crisis wey happun for 2022 wey be say clarity no dey for di education sector.

"We don ensure di seamless transition of learners from primary to junior secondary and domicile Grade 7, 8 and 9 for primary school, to make di best use of existing infrastructure".

Ruto say e don employ 56,000 teachers and e go still recruit 20,000 odas to join dem for January 2025.

Dis na sake of shortage of 110,000 teachers and 23 out of 40 universities almost close down for Kenya.

  • Threat to life

Di Kenya protest wey hit di country some months ago still get plenti impact.

Allegations of pipo wey disappear still dey ground.

Ruto say e don resolve di issue of protest and how pipo bin disappear during di protest.

"Plenty allegations dey concerning di disappearances of pipo during protests. A number of dis cases don dey resolved while odas na fake news wey spoil di efforts to find genuine cases of missing pesin," Ruto tok.

Di president add say, e no dey give room for illegal arrests and e condemn every action wey go put di lives and freedom of pipo of Kenya for serious threat to life.