How pipo decide to slay di red carpet for di AMVCA

Mercy Aigbe
Wetin we call dis foto, AMVCA Best Supporting Actress Mercy Aigbe represent wit celestial bodies for her cloth
Read am in 3 mins

"If to say I enta Met Gala wit wetin I wear come dis AMVCA, I got shut am down".

Dat na wetin Hollywood actor, Jimmy Jean-Louis tell BBC Pidgin as e dey waka for red carpet dey check out di fashion.

Nigerian celebs wear dresses and outfits of different kinds come show out for di red carpet for di main event.

Weda na Enioluwa Adeoluwa, velvet look, abi na di branches wey dey comot from di back of Nigerian actress Osas Ighodaro dress or di rotating parts of Ghana actress and socialite, Nana Akua Addo white piece, you no go tok say dem no show up and show out for di red carpet.

Beauty Tukura
Enioluwa and Tobe
Nigerian comedian, Basketmouth
Ini Dima-Okojie
Wetin we call dis foto, Ini Dima-Okojie
Nana Akua Addo

Recently, di world don torchlight Nigeria fashion sotay tins like Owambe makeup, and Nigerian custom fits bi feature well-well for di Met Gala on Tuesday.

Even sef Nigerian stars get dia debut for one of di biggest Night for fashion.

Howeva pipo no really gbadun am.

Di tin about African fashion be say while details dey dia, wey fit dey subtle, di message for any outfit dey loud, and shouted from di rooftops.

Anddis done make Nigerian fashion to dey appreciated worldwide.

Erica Nwedilim
Gbubemi Ejeye
Wale Ojo