King Promise win Artiste of di year, oda winners for for 2025 Ghana Music Awards

promise receives plaque

Wia dis foto come from, GHANA MUSIC AWARDS/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, King Promise beat stiff competition to win artiste of di year for di Ghana music awards
Read am in 5 mins

Afrobeat musician King Promise don win artiste of di year for di 2025 Ghana music awards.

Dis na afta im beat competition from di 2024 winner Stonebwoy and King Paluta for di event wey happun Saturday night.

Mani fans and sabi pipo bin tip di "continental" hit-maker to win di award afta im get more than eight nominations wit four ogbonge songs wey dey on top im "True to self" album.

Oda songs like "Paris", "Sexy" and "Continental" on top di album don hit wia dem get plenty stream numbers wia dem also play for di parties, clubs and di streets.

King Promise tok say im tank im fans and family for dis award.

"Praises to Baba God, my team, di pesin wey discover me. My mama and papa do everitin."

King Promise wey carry im mama and papa go di stage to collect di award tok say "if any young pesin gat dream, make i be your inspiration."

"Di first time i enta di music industry, i bin get 7 nominations, but i neva win any award, but i neva sleep, i bin work hard, wia today i dey hia as artiste of di year."

Im add say "today i be di chosen one".

Apart from di artiste of di year award, King Promise also bin win three oda awards.

Im win afrobeat artiste of di year, album of di year (True to self album), and best afropop song of di year.

King Promise

Wia dis foto come from, GHANA MUSIC AWARDS/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, King Promise also win afrobeat artiste of di year, album of di year (True to self album), and best afropop song of di year.

Stonebwoy wey bi di 2024 artiste of di year bin win 3 awards for di night.

Di "jejereje" hit-maker win reggae/dancehall artiste of di year, reggae/dancehall song of di year and music video of di year for im song "Jejereje".

Di oda pesin wey be among di favourites to win artiste of di year, King Paluta also bin win three awards.

King Paluta win most popular song of di year (Aseda), best highlife song of di year and producer of di year.

Kweku Smoke also bin win three awards - best hiphop/hiplife artiste, best rap performance and best hiphop song (Holy Ghost).

Gospel artiste Joe Mettle wia also bin dey di artiste of di year categroy win gospe artiste of di year, male vocalist of di year, same as Team Eternity (gospel group), also bin win two awards - group of di year, and contemporary gospel song of di year.

stonebwoy

Wia dis foto come from, GHANA MUSIC AWARDS/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Stonebwoy, King Promise, King Paluta and odas perform for di stage

For pesin to win di artiste of di year award, im gat to dey adjudged by di academy, di board and di public as di artiste wit;

- Di highest audience appeal and popularity for di year under review

- Di artiste gatz release hit single/EP/Album

- Di artiste gatz be one of di pipo wit di highest number of nominations for di year.

Oda winners for di Ghana Music Awards

Best new artiste

Lali x Lola

AratheJay

Rap Fada

Team Eternity (WINNER)

Beeztrap Kotm

Kwasi Amewuga

Best male vocal performance

Kofi Nuel - Do not fear

Emmanuel Juddah - Aseda

MoG Music - Ahuoden Fofro

Ayisi - Can I live

Joe Mettle - Obo Awon Oba (WINNER)

Best female vocal performance

Naana Asiedu - Defe Defe

L'ordine the soprano - Simply trusting everyday

Esther Goodwyll - I choose to praise (WINNER)

Titi Owusu - Nobody

Mima Afrika - On fire

Best Hiplife/Hiphop ariste

Amerado

Beeztrap Kotm

Kweku Smoke (WINNER)

Black Sherif

King Paluta

Sarkodie

Medikal

Best rap performance

Eno Barony

Kweku Smoke (WINNER)

Okyeame Kwame

Sarkodie

Lyrical Joe

Flowking stone

Best gospel artiste

Piesie Esther

Joe Mettle (WINNER)

Empress Gifty

Diana Hamilton

Team Eternity

MoG Music

Best hiphop song

Joey B - Princess

Kweku Smoke - Holy Ghost (WINNER)

Kwaw Kese ft Kofi Mole - Awoyo Sofo

Black Sherif - Kilos Milos

Sarkodie ft Beeztrap - Amen

Beeztrap & Oseikrom Osikani - Fly Girl

Best Afro beat song

Olivetheboy - Asylum (WINNER)

Lasmid - Puul

Kidi ft Black Sherif - Lomo Lomo

Mr Drew - Sneaky

King Promise - Favorite Story

Beeztrap Kotm - Yesu

Best hiplife song

Eno Barony ft King Paluta - Soja Go Soja Come

Black Sherif - Rebel Music

Tulenkey ft Beeztrap - Bad Feeling (WINNER)

Okyeame Kwame ft Kuami Eugene - No competition

Sarkodie - No sir

Lyrical Joe ft Kuami Eugene - Enter

Best highlife song

Kuami Eugene - Canopy

King Paluta - Aseda (WINNER)

Fameye - Very Soon

Amerado - Abronoma

Rap fada ft King Paluta - Odo bi ye bad

Kofi Kinaata - Effiekuma broken heart

Best urban contemporary gospel

Scott Evans - Call

Joe Mettle ft Sandra Duah - Give me oil

Nana Yaw Ofori Atta (Team eternity) - Defe Defe (WINNER)

Kobby Salm - Cast your burden

Ohemaa Mercy ft Kofi Owusu - Dry Bones

Best traditional gospel song

MoG Music - Wo Ye

Diana Hamilton - The doing of the lord

Mavis Asante - Victory

Queendalyn ft Judikay - Omewoya

Empress Gifty - Watch me (WINNER)

Piesie Esther - Ateene

Best Reggae/dancehall song

Amerado ft Shatta Wale - Ankomoma remix

Stonebwoy - Psalm 23 (WINNER)

Ras Kuuku - Road to evil

Samini - Chemistry

Jupiter - I keep winning

Moliy & Silent Addy - Shake it to the max

Best reggae/dancehall artiste

Jupiter

Samini

Ras Kuuku

Epixode

Stonebwoy (WINNER)

Rocky Dawuni

Songwriter of the year

Ayisi

KofiKinaata (WINNER)

Okyeame Kwame

Olivetheboy

Team Eternity

Telecel most popular song

OliveTheBoy - Asylum

Kidi ft Black Sherif - Lomo Lomo

Lasmid - Puul

King Paluta - Aseda (WINNER)

Black Sherif - January 9

King Promise - Paris

Team Eternity - Defe Defe

Stonebwoy - Jejereje

International collaboration

Diana Hamilton ft Mercy Chinwo - The doing of the Lord (WINNER)

Best Africa song

Tshwala Bam - Titom, Yuppe & Burna Boy (WINNER)

Music for good

Epixode (WINNER)