Frank Lampard chop sack as Everton manager afta West Ham defeat

Frank Lampard

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Frank Lampard

Everton don sack manager Frank Lampard afta less dan one year wey e dey in charge for Goodison Park.

Defeat to dia fellow strugglers West Ham United on Saturday be Everton ninth loss for di 12 Premier League games.

Dem be di second from bottom of di table wit 15 points from 20 matches, above Southampton on goal difference.

Former England midfielder Lampard, wey be 44, bin replace Rafael Benitez for January 2022 wit di team 16th for di table and help Everton to avoid relegation.

Everton now dey look for dia sixth permanent manager inside five years.

Afta one 1-1 draw for reigning champions Manchester City for 31 December, Everton don lost 4-1 to Brighton for Goodison Park, bin dey knock out of di FA Cup wit 3-1 defeat for Manchester United and dey beaten by Southampton despite say dem take di lead, bifo di latest defeat by West Ham.

Dem don manage only three wins all season

E bin get widespread and voice protests from fans against di board for recent games, and supporters bin stage one sit-in demonstration afta di loss to Southampton.

Everton board of directors bin miss dat game sake of wetin di club claim be one "real and credible threat to dia safety".

Merseyside Police say no threats or incidents don dey reported to officers bifo di fixture bifo Everton announce say "more security procedures" go dey in place.

Dat also be di answer to some supporters wey dey confront defender Yerry Mina and midfielder Anthony Gordon as dem commot Goodison Park inside dia cars last weekend.

Everton owner Farhad Moshiri bin attend im first game for 14 months for West Ham, wit long-serving chairman Bill Kenwright wey dey face criticism. Moshiri bin suggest, wen Sky Sports bin kwesion am for di game, say no be im go decide Lampard future.

Di club never sign anybody for January transfer window but spend excess of £80m for di summer, including di £33m signing of Amadou Onana from Lille and £20m purchase of Dwight McNeil from Burnley, afta e receive £60m for Brazil forward Richarlison from Tottenham.