Golden Globe awards 2025 nominations

Ariana Grande and Cynthia Erivo face each oda and both of dem dey look sideways for di same direction, for di Australian premiere of Wicked for November.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Ariana Grande name dey supporting actress categories, while Cynthia Erivo name classed as Wicked's lead actress
Read am in 6 mins

Wicked actress Cynthia Erivo and Ariana Grande dey among di stars wey collect nominations for di Golden Globes, as Hollywood award season kicks off.

British actress Erivo dey shortlisted for best female actor for a comedy or musical for her role as Elphaba for di hit feem, while her co-star Grande name dey for best supporting female actor.

Angelina Jolie, Hugh Grant, Timothee Chalamet, Sebastian Stan, Demi Moore, Pamela Anderson, Kate Winslet and Selena Gomez dey among di oda big names wey collect nomination too.

Di Golden Globes don face some controversy in recent years but e still remain di first major awards for feem calendar, and e dey provide pointers for who fit do well for next year Oscars.

Netflix musical Emilia Pérez, about one Mexican drug lord wey dey change im gender, dey lead di nominations overall wit 10, including one for Gomez.

Oda popular feems include heavyweight dramas The Brutalist, about one Hungarian architect wey try to build a new life for US afta World War Two, and Conclave, about a group of scheming cardinals wey gada to select di new Pope.

Selena Gomez dey centre of one group of women wey dey dance wit nightclub-style green and red lights

Wia dis foto come from, Netflix

Wetin we call dis foto, Selena Gomez wey dey (centre) get two acting nominations dis year

Di top feem nominees:

  • Emilia Perez - 10
  • The Brutalist - 7
  • Conclave - 6
  • Anora - 5
  • The Substance - 5

Unlike di Oscars, di Golden Globes also get awards for TV shows, The Bear, Only Murders for di Building, Shogun and Baby Reindeer na di main contenders for dos categories.

Oscar contenders

Jolie na di frontrunner to win best feem drama female actor for playing legendary opera singer Maria Callas for Maria.

She go face competition from Nicole Kidman for Babygirl, as well as Anderson for playing a veteran Las a Vegas showgirl for Di Last Showgirl.

British stars Winslet and Tilda Swinton also dey dat category, wit Brazilian actress Fernanda Torres.

Winslet get two nominations in total - one on di feem side for playing war photographer Lee Miller, and one for her TV show Di Regime.

Adrien Brody smoking in the twilight apparently looking into a fire as sparks fly up in The Brutalist

Wia dis foto come from, Universal Pictures

For di best feem drama male actor race, many see Di Brutalist Adrien Brody and Conclave actor Ralph Fiennes as di main contenders.

Meanwhile, Stan dey nominated for playing Donald Trump for Di Apprentice, about di incoming US president early years, and dem recognise Chalamet for playing singer Bob Dylan for A Complete Unknown.

Joining dem on dat shortlist na former James Bond star Daniel Craig for playing a US expat for1950s South America for Queer, and Colman Domingo for im role for Sing Sing, about a prison theatre group.

All of dem go also get a shot of receiving Oscar nominations wen dem announce di nominees forJanuary.

Newcomers and veterans

Unlike di Oscars, di Golden Globe split most of dia categories into two, wit one award for dramas and a separate prize for musicals/comedies.

Many dey tip newcomer Mikey Madison for di award for best film musical/comedy female actor for playing a New York stripper wey fall for di son of a Russian oligarch for Anora.

She go take on odas including Demi Moore, wey many praise for playing a veteran Hollywood star wey go to extreme lengths to recapture her youth for body horror Di Substance. Na Moore first nomination for 28 years.

Mikey Madison and Mark Eidelstein for Anora

Wia dis foto come from, Neon

Wetin we call dis foto, US actress Mikey Madison (right) collect her first Globe nomination for Anora

Zendaya, Amy Adams and Karla Sofía Gascón dey di same category, as wit Erivo, one of four nominations in total for Wicked.

Di feem, dey based on di Broadway musical about di origin story of di Wicked Witch of di West from di Wizard of Oz, go hope to combine di awards praise wit commercial success afta e make $455m (£356m) so far for di box office.

Grande go, go up against fellow singer and former children's TV star Gomez, wey play di wife of di drug lord for Emilia Pérez.

Gomez wey be double nominee, also dey shortlisted for TV comedy Only Murders in di Building.

British talent

Erivo dey among a number of British stars for di shortlists.

Grant dey collect im seventh Golden Globe nomination of im career, for horror feem Heretic, while Felicity Jones get her second, a decade afta her first for Di Theory of Eviritin.

Her co-star for dat feem, Eddie Redmayne, dey also hope for a Golden Globe dis year, for im TV show Di Day of di Jackal.

Im go, go up against Gary Oldman, for Slow Horses, while im co-star Jack Lowden dey di list for one of di supporting categories.

Elsewhere, Keira Knightley dey nominated for her new spy drama Black Doves. Her competitors include Emma D'Arcy, who get House of di Dragon only citation.

Richard Gadd stand a strong chance of winning best male actor for a limited series for Baby Reindeer. Im rivals include fellow Scot Ewan McGregor, for A Gentleman in Moscow.

Baby Reindeer Jessica Gunning dey in di running for best supporting female TV actor.

However, no nomination for Britain Marianne Jean-Baptiste, wey many bin dey tip to dey recognised for her role in director Mike Leigh hard-hitting feem Hard Truths.

Di winners of di Golden Globe winners dem go announce am for ceremony for Los Angeles on 5 January, followed by di Oscars on 2 March. Di host, Nikki Glaser, dey nominated too for best TV stand-up for Nikki Glaser: Someday You'll Die.

Di join body wey bin dey behind di Globes, di Hollywood Foreign Press Association, bin face criticism for 2021 for corruption and a lack of diversity for dia voting body, and dem face accuse of accepting "freebies" in exchange for nominations and oda ethical lapses.

Sake of dat, di join body expand and diversify dia membership, dem implement a new code of conduct, and change dia name.