How Senegal bounce back to beat host Qatar 3-1 for World Cup

Wia dis foto come from, Getty Images
Senegal become di first African team to win a game for dis World Cup afta dem beat di host kontri Qatar 3-1 for dia group A match.
Both teams bin come out fighting but Qatar fit exit di competition soon.
Di Middle East side bin battle valiantly but dem go comot or still get chance to play one game if di Netherlands avoid defeat against Ecuador later on Friday
But African champions Senegal dey up and running.
Boulaye Dia break di deadlock four minutes before half-time, as im slam to punish Boualem Khoukhi miscalculated clearance.
Looking to hit back for di second period, dem dash Qatar hope wen former Bristol City striker Famara Diedhiou rise to nack one ogbonge header just three minutes afta di break.
Watford Ismaila Sarr bin get early chance on im 50th cap but strike am inside di side net, as Idrissa Gueye of Everton also miss one narrow chance.
Qatar bin feel say dem fit gbab one first-half penalty wen Sarr bundle Akram Afif ova inside di box, but referee Antonio Lahoz point only for one goal-kick, and dis one even vex di home supporters.
End of Di one wey oda users dey read well well
Chelsea goalkeeper Edouard Mendy make one stunning reflex save to deny Almoez Ali and Ismail Mohamad, but im no fit do anything about Mohammed Muntari powerful header.
Qatar bin dey find di equaliser, but Bamba Dieng strike in to deflate di home following and leave dia team for bottom of di group without a point afta dem don play two games.
How di match waka
FIRST HALF: KICK-OFF
Qatar start wit dia all-maroon strip.
3 mins: Kalidou Koulibaly (Senegal) bin attempt to find one of im teammates wit one fine lofted pass, but di defence react well to stop di effort.
4 mins: Di opposition no fit get near Ismaila Sarr (Senegal), wey finally take a shot inside di box. Di effort be like wetin dey goalbound but go off just wide of di right post at di last second.
6 mins: Dem flag Akram Afif (Qatar) for offside.
9 mins: Nampalys Mendy gbab one pop from di edge of di box for Senegal but im drag am wide.
11 mins: Senegal dey up to around 60% possession for dis game. Qatar need to stay disciplined for di back and keep dia shape.
14 mins : Qatar go long and dem gbab a chance to relieve some pressure as Kalidou Koulibaly trip Almoez Ali.
Qatar get free-kick for one decent position wey fit get di ball into di box.
15 mins: A sight of goal for di hosts but Akram Afif no fit hit di target.
17 mins: Pedro Miguel (Qatar) need medical treatment, so di referee stop play and signals for di physio to come onto di pitch.
18 mins: Pedro Miguel (Qatar) fit continue to play.
19 mins: Abdou Diallo (Senegal) dey move okay again afta di injury scare.
21 mins: Former Barcelona youth coach Felix Sanchez no look happy wit im Qatar team at di moment.
Dem dey into di game but dem dey spend too much time on di back foot.
21 mins: Youssouf Sabaly (Senegal) try to find di head of one teammate in di box but overhits di cross. Di ball go out of play and Qatar go get a goal kick.
22 mins : Ismail Jakobs (Senegal) take di free kick and attempt to find some of im teammates inside di box, but dem stop di ball.
24 mins: Idrissa Gueye (Senegal) volleys di ball on di edge of di box afta one rebound.
25 mins: Idrissa Gueye (Senegal) try to find Youssouf Sabaly, but im put too much power on di pass.
26 mins : Abdelkarim Hassan (Qatar) rushe one shot from long range and subsequently send am high ova di bar.
27 mins: Senegal dey very much on top at di moment. Di hosts dey struggle to lay one glove on di Africa Cup of Nations champions.
28 mins: One early positive for Qatar...
Di hosts don already get as many touches for di opposition box (two) as dem do for dia World Cup opener against Ecuador (also two).
33 mins: Qatar on di break!
34 mins: No be penalty be dat? Na so di hosts think so as Ismaila Sarr send Akram Afif tumbling.

Wia dis foto come from, Getty Images
GOAL - Qatar 0-1 Senegal
41 mins: Boulaye Dia don score
Senegal neva lose any World Cup match wen dem don score first previously (dem don win two and draw two).
45+1 mins: Dem don add seven minutes.
45+3mins: 'Ismaila Sarr (Senegal) send one cross into di box, but Meshaal Barsham come off im line to gada di ball.
45+6mins: Edouard Mendy display im ability to read di game and clear di danger afta Almoez Ali (Qatar) threaten to latch onto one through ball from just outside di box.
45+8mins: Antonio Mateu Lahoz blow im whistle to signal di end of di first-half action.

Wia dis foto come from, Getty Images
SECOND HALF
KICK-OFF Qatar 0-1 Senegal
Di teams don come out. No changes for either at di break as di game don start again.
Good run forward by Ismaila Sarr down di right don make Senegal gbab corner as Abdelkarim Hassan get across on di cover.
GOAL - Qatar 0-2 Senegal
48 mins: Famara Diedhiou don score for Senegal.
50 mins: Famara Diedhiou (Senegal) dey too fierce for im attempt to get di ball from im opponent and Antonio Mateu Lahoz blow for a foul.
52 mins: Di linesman flag go up. Dem catch Abdelkarim Hassan (Qatar) for di offside trap.
52 mins: Today referee Antonio Mateu Lahoz decide to book Ismail Jakobs (Senegal) for im harsh tackle.
56 mins: Abdelkarim Hassan (Qatar) control di ball inside di six-yard box afta di resulting free kick, but im teammates block im effort.
63 mins: Almoez Ali (Qatar) take one defence-splitting pass in di box. Without even looking up e drill one shot towards di bottom left corner, but Edouard Mendy pull off one brilliant save. Qatar go now take a corner kick.
64 mins: Substitution. Pathe Ciss (Senegal) don come onboard to replace Krepin Diatta.
67 mins: Ismaeel Mohammad (Qatar) connect wit one cross and shoots to di left side of di goal, but im no fit get di power to direct am pass Edouard Mendy, wey make a good save. Qatar force a corner. Dia opponents go face anodar attacking threat.
69 mins: Substitution. Qatar player Karim Boudiaf comot di pitch dem use Abdulaziz Hatem replace am.
74 mins: Di end of di game for Hasan Al Haydos, wey dem replace wit Mohammed Muntari (Qatar).
78 mins: GOAL! Mohammed Muntari (Qatar) make am 1:2. Im jump highest to connect wit one perfect cross from Ismaeel Mohammad and plant im close-range header into di left side of di goal. Edouard Mendy dey helpless.
83 mins: Tarek Salman (Qatar) join di action as a substitute, to replace Homam Ahmed.
84 mins: Goal!
One precise cut back on di goal line from Iliman Ndiaye as im find Bamba Dieng (Senegal) right in front of goal, and im easily bury di ball into di middle of di goal.
87 mins: One yellow card for tackle by Pathe Ciss (Senegal). Antonio Mateu Lahoz no dey hesitate at all to make dis decision.
89 mins: Close! Abdelkarim Hassan (Qatar) take di resulting free kick from one promising position, but im effort flies inches wide of di right post.
Qatar 1-3 Senegal
Referee don add six minutes extra time.
90+1mins: Assim Omer Madibo (Qatar) see one yellow card from Antonio Mateu Lahoz afta im send one of di opposing players to di ground.
90+7mins: Di referee blows for di end of di match.
FULL-TIME: Qatar 1-3 Senegal













