New IGP of Police: President Buhari don appoint Usman Alkali Baba as Acting Inspector General of Police

Wia dis foto come from, Police
Nigeria President Muhammadu Buhari don appoint DIG Usman Alkali Baba as di new acting Inspector General of Police.
Usman Alkali Baba go take over from Adamu Mohammed, di former Inspector General of Police with immediate effect.
Di Minister of Police Affairs Maigari Dingyadi dro di infor on Tuesday afternoon.
Before im appointment, oga Baba be di head of Force Criminal Intelligence and Investigation Department (FCIID).
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post

President Buhari for February 4th bin extend Adamu tenure for three months afta e replace di oda service chiefs.
Adamu wey currently dey Imo state, wia e go check di damage wey some jaguda pipo do for di police headquarters and di prison for Owerri don dey office since 2019.






