Chimamanda Adichie: Ogbonge Author narrate im last moments wit her father

Chimamanda Adichie

Wia dis foto come from, Instagram/Chimamanda Adichie

Wetin we call dis foto, Author Chimamanda Adichie write letter to mourn her father wey die last month
Read am in 2 mins

Chimamanda Adichie, di ogbonge Nigerian author, don write soulful message to take mourn her father wey just die.

Her father, James Adichie, wey be Professor of Statistics and Mathematics, die on June 10, 2020, after im sick small for house.

Di younger Adichie say she follow her father tok on June 9, one day before im die. She say 'Good night' be her father last word to her wen she follow am tok di day before im death.

For di fine writing wey Chimamanda post for her Instagram page, she say she bin don dey fear tey tey di day wey her papa go die sake of say she love am so much.

Chimamanda tok about how everybody for di family dey miss her papa and how dem dey plan burial even for dis time of coronavirus.

Chimamanda Adiichie father die for June 10

Wia dis foto come from, Instagram/ CHimamanda Adichie

"Sleep na my only relief. Wen I wake, how big and say na final go hit me say I no go see my papa again. Neva again. I go crash and sober again. E dey do me to run, to even hide. To no dey think deep n aim safe for me because if I tink am deep, di pain go dey too much. All di tomorrows wey dey without my papa, even im wisdom and im grace," na wetin Chimamanda Adichie write about how her father death dey pain her.

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Instagram post

She even tok all di good times wey she spend wit her papa and how he dey always follow her tok before she enter stage. Nothing dey mata to me more dan di pride wey dey dey im face, she say.

"I dey write about my father for past tense, and I no fit believe say na my father I dey tok about for past tense. My heart dey break," be how she conclude her letter.