Ayman al-Zawahiri profile: Osama Bin Laden successor and al-Qaeda leader wey US kill, who e be?

Wia dis foto come from, AFP
America don kill di leader of al-Qaeda, Ayman al-Zawahiri, inside one drone strike for Afghanistan, President Joe Biden don confam.
Dem kill am inside counter-terrorism operation wey di CIA carri out for di Afghan capital of Kabul on Sunday.
Mr Biden say Zawahiri bin don "commit murder and violence against American citizens".
"Now justice don dey delivered and dis terrorist leader is no more," e add.
Zawahiri take over al-Qaeda afta di death of Osama Bin Laden for 2011. E and Bin Laden plan di the 9/11 attacks togeda and e be one of di US "most wanted terrorists".
Officials say Zawahiri bin dey for balcony of one safe house wen di drone fire two missiles at am.
Oda family members bin present, but dem no harm dem and only Zawahiri dem kill for di attack, dem add.

Wia dis foto come from, Getty Images
Who was Ayman al-Zawahiri?
Mr Biden say e give di final approval for di "precision strike" on di 71-year-old al-Qaeda leader afta months of planning.
End of Di one wey oda users dey read well well
Im killing go bring closure to families of di nearly 3,000 victims of di 2001 attacks, Mr Biden add.
"No mata how long e take, no mata wia you hide, if you be threat to our pipo, America go find you and take you out," Mr Biden tok as e add say "we shall never stop from defending our nation and im pio".
Dem dey refer to Ayman al-Zawahiri as di chief ideologue of al-Qaeda.
E be eye surgeon wey epp found di Egyptian Islamic Jihad militant group, e take over di leadership of al-Qaeda following di killing by US forces of Osama Bin Laden for May 2011.
Before dat, Zawahiri dey considered Bin Laden right-hand man and some experts believe say na im be di "operational brains" behind di 11 September 2001 attacks for di United States.
Zawahiri was number two - behind only Bin Laden - in the 22 "most wanted terrorists" list announced by the US government in 2001 and had a $25m (£16m) bounty on his head.
In di years afta di attacks, Zawahiri emerge as al-Qaeda most prominent spokesman, e appear in 16 videos and audiotapes in 2007 - four times as many as Bin Laden - as di group triy to radicalise and recruit Muslims around di world.

Wia dis foto come from, Reuters
Im killing for last weekend attack in Kabul no be di first time US bin try to target Zawahiri.
For January 2006, e be di target of one US missile strike near Pakistan border with Afghanistan.
Di attack kill four al-Qaeda members, but Zawahiri survive and appear on video two weeks later, dey warn US President George W Bush say neither im nor "all di powers on earth" fit bring im death "one second closer".
Distinguished family
Dem born Zawahiri for di Egyptian capital, Cairo, for 19 June 1951, and e come from a respectable middle-class family of doctors and scholars.
Im grandfather, Rabia al-Zawahiri, na di grand imam of al-Azhar, di centre of Sunni Islamic learning for di Middle East, while one of im uncles na di first secretary-general of di Arab League.
Zawahiri become involved in political Islam wen e still dey school and dem arrest am at di age of 15 for being a member of di outlawed Muslim Brotherhood - Egypt oldest and largest Islamist organisation.
Im study medicine for Cairo University medical school, e graduate for 1974 and obtain im masters degree in surgery four years later.
Im papa Mohammed, wey die for 1995, na pharmacology professor for di same school.
Zawahiri bin continue di family tradition, e build medical clinic for di suburb of Cairo, but e soon become attracted to radical Islamist groups wey dey call for di overthrow of di Egyptian goment.
Wen dem found di Egyptian Islamic Jihad for 1973, e join.

Wia dis foto come from, AFP
In 1981, he was rounded up along with hundreds of other suspected members of the group after several members of the group dressed as soldiers assassinated President Anwar Sadat during a military parade in Cairo. Sadat had angered Islamist activists by signing a peace deal with Israel, and by arresting hundreds of his critics in an earlier security crackdown.
During the mass trial, Zawahiri emerged as a leader of the defendants and was filmed telling the court: "We are Muslims who believe in our religion. We are trying to establish an Islamic state and Islamic society."
Although he was cleared of involvement in Sadat's assassination, Zawahiri was convicted of the illegal possession of arms, and served a three-year sentence.













