Bah Ndaw and Assimi Goita go lead Mali as transitional leaders

Mali junta leader and new transition vice president Colonel Assimi Goita (L) with the new transition president former defence minister Bah Ndaw (C) and Colonel Malick Diaw (R) of the National Committee for the Salvation of the People (CNSP) pose for a photograph during a meeting with Economic Community Of West Africa (ECOWAS) in Bamako, Mali, 24 September 2020. The 70-year-old Bah Ndaw who had been retired was appointed transition president by a committee chosen by the junta.

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Bah Ndaw (C) with junta leaders Col Assimi Goita (L) and Col Malick Diaw (R) on Thursday
Read am in 3 mins

Mali former Minister of Defense Bah N'Daw na im dem don appoint as di kontri president for di main time alias Transitional President for di next 18 months.

Na on Monday di college bin arrange di appointment and offices of pipo wey go lead di transition.

Na coup leader, Colonel Assimi Goita pick di 70 years old former Defence Minister Bah Ndaw, to head di transitional government until di elections.

Di head of di military junta wey dey behind di 18 August coup, Colonel Assimi Goita na im dem appoint vice-president of di transition.

Dem neva release di identity of di prime minister.

Di appointment of civilian president na condition for di West African regional group, Ecowas, to lift di sanctions dem sama dem afta di coup.

Stocks of goods bin dey run low for di capital, Bamako, wia businesses dey hope to get announcement from Ecowas afta di inauguration.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Who be General Bah N'Daw?

Dem born di retired soldier for August 23, 1950 for di region of Segou.

He hold certificate of Higher Military Study from France and anoda certificate from War School (CID) for 1994. He get brilliant career for di Ar Force.

Di former Minister of Defense and Veterans Affairs come from di 7th promotion (1973) of di Joint Military School (EMIA), Koulikoro.

After im graduation, he join army as volunteer for June 1, 1973.

Di following year, dem appoint am to take helicopter pilot course for di USSR.

Bah Ndaw work as defence minister under Ibrahim Boubacar Keïta

Wia dis foto come from, AFP

For March 27, 2014, former President Ibrahim Boubacar Keita appoint am as di Minister of Defense and Veterans Affairs.

Colonel-Major Bah N'Daw, wey im paddys nickname "the great" because of im height (1.95 m), na former helicopter pilot trained for before USSR and im be former aide-de-camp to General Moussa Traoré.

From 2008 until he retire for 2012, Colonel-Major Bah N'Daou na di Director of di National Office for Veterans, Retired Military and War Victims.

Major General Bah N'Daw na Officer of di National Order of Mali, dem also decorate am wit Medal of Military Merit and di Medal of National Merit.

CNSP na im recommend am for di position sake of im rich military career and based on say im dey hardworking.

Di swearing-in ceremony go hold dis Friday, September 25, 2020

French Defense Minister Jean-Yves Le Drian and im Malian counterpart Bah N'Daw pose on July 16, 2014 in Bamako

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin happun for Mali?

Soldiers bin arrest Mali president on Tuesday some hours afta dem start mutiny for Kati camp.

President Ibrahim Boubacar Keïta, bin dey im house for Sebenikoro, Bamko, wen some soldiers come arrest am around 4:30pm Mali time.

Mali goment tok-tok pesin, Yaya Sangaré, tell BBC say di military arrest am wit di Prime Minister, Boubou Cissé.

Di kontri bin don dey boil for some months sake of politics palava as kontri pipo bin do plenty protest for di president to resign sake of di plenty jihadist attacks plus corruption for di economy.

During consultation last week, dem bin define g fit occupy di office of di president of transition.

According to di criteria, na must say di president of transition go come from Mali, between 35 and 70 years old, no go be lie-lie pesin and e go get good character.

Im no go get any criminal sentence.

Di prime minister and members of di transitional goment must also meet di same criteria wit di president.

During di 57th Ecowas summit wey dem do for 7 September, 2020 for Niamey, Niger, di Economic Community of West African States bin give di military junta until September 15 to give one civilian transitional power.