Malick Diaw: Malian military coup Colonel Malic Diaw and odas leaders hold meeting wit opposition afta coup d'état - See how former French colonies for Africa di break record wit coup

Wia dis foto come from, AFP
Mali Coup 2020 latest tori be say di leaders of Tuesday military coup d'état do meeting wit di opposition leaders for di west African kontri.
Di opposition leaders support di army as dem remove President Ibrahim Boubacar Keita wey dem blame for di economic palava for dia kontri.
Dem say im fail to stop di Islamist militants wey dey worry dem well-well.
Tori be say former French Colonies don get trend for plenti coups dan di rest of Anglophone alias English speaking African kontris.
Mali na one of de former French colonies weh army take ova pawa, force President Ibrahim Boubacar Keita for resign for August 18.
History for coup for Francophone (French speaking) Africa
History for coup for Africa show say di first coup afta independence happun for Togo for 1963.
But experts dey quick to point out say inside 60 years, 27 African kontris don get 67 coup; 45 for 16 of di kontris na for former kontri weh France colonise dem.
Some of di kontris weh deh don get one or two coups na Togo, Tunisia, Madagascar, Ivory Coast, Rwanda, Algeria, Zaire, Mali and Guinea Conakry.
End of Di one wey oda users dey read well well
Den kontris wit more than three coups, Congo, Chad, Burundi, Niger, Central Africa, Mauritania, Comoros Island and Burkina Faso.
One tin weh e bi common for all di Francophone (alias kontris na say dem get French military base for protect dem in case of attack.
But, experts say de real function for de army na source for political violence under cover for military defence secret.
All de kontris di pay colonial tax, di keep dia moni for French treasury, but deh no fit komot all de moni.
Corruption and poverty, and president weh deh don ova stay for pawa na common tin for former French colonies.














