Mutiny: Coup in Mali, meaning of Mutiny, arrested Malian president Ibrahim Boubacar Keïta and di military coup d'etat wey colonel Malick Diaw and oda generals do

Wia dis foto come from, EPA
Crowds of pipo for Malian capital Bamako, dey celebrate and happy outside di residence of dia President, Ibrahim Boubakar Keita afta military men arrest and detain am on Tuesday.
Di masterminds of di Mali coup wey remove President Ibrahim Keïta include di deputy of di Kati camp Col Malick Diaw and oda generals.
Later for night oga Keita present im resignation during one televised address and also announce say im don dissolve di goment plus di national assembly.
Di West African regional bloc Ecowas don condemn wetin dem call "military putsch"

Wia dis foto come from, EPA
Wetin be Mutiny and wetin we know so far about Mali Mutiny
Oyibo pipo define Mutiny as criminal conspiracy among group of pipo (typically members of di military or crew members of any ship, even if all of dem na civilians) to disobey or overthrow lawful authority.
For Mali, ogas dem for military wey lead di mutiny na Col Malick Diaw - deputy head of di Kati camp - and anoda commander, Gen Sadio Camara, according to di report from BBC Afrique's Abdoul Ba wey dey Bamako.
Afta taking ova di camp, about 15km (nine miles) from Bamako, di mutineers march go di capital, wia crowd of pipo wey bin gada to demand oga Keïta to resignation begin clap for dem.
On Tuesday afternoon dem tier enta oga Keita residence and arrest im and e prime minister.
End of Di one wey oda users dey read well well

Wia dis foto come from, Reuters
Report say di mutineers also detain di president son, di speaker of di National Assembly, di foreign and finance ministers plus oda officials.
Di number of soldiers wey take part for di mutiny no dey clear.
Kati camp na also di focus of one mutiny for 2012 wen soldiers wey dey vex for di inability of di senior commanders to stop jihadists and Tuareg rebels taking control of northern Mali.












