Mali coup 2020: Mutiny leaders wey ensure resignation of Malian President Ibrahim Boubacar Keïta don declare plan to set up transitional goment

Mutiny in Mali crisis

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Ibrahim Boubacar Keïta

Mali coup leaders don promise new elections afta dem remove President Boubacar Keïta

Earlier before dis announcement, di Mali military junta close di kontri borders and impose curfew.

Di sojas wey remove di Malian President say dem plan to set up one civilian transitional goment alias caretaker rulers until dem conduct elections.

Di coup leaders wey dey call demsefs di National Committee for di Salvation of di Pipo, say dem no wan to stay in power.

Tok tok pesin for di sojas tell tori pipo say dem act to prevent di kontri from falling further into katakata alias chaos but dem no mention election date.

Di capone masterminds of di Mali coup wey remove President Ibrahim Keïta include di deputy of di Kati camp Col Malick Diaw and oda generals.

One delegation of west African heads of state dey expected in Mali on Wednesday, according to Mali EU-funded Studio Tamani news website.

Niger President Mahamadou Issoufou, Senegal Macky Sall, Ghana Nana Akufo-Addo and Ivory Coast Alassane Ouattara dey expected in Mali, the website reports.

Mali President Ibrahim Boubacar Keïta resign alias comot from office just hours afta sojas bin arrest and detain oga Keïta and Prime Minister Boubou Cissé for di kontri biggest military camp near di capital Bamako.

Armed forces in Mali knack out President Ibrahim Boubacar Keïta from powerbut di UN and AU don reject di military takeover.

Wetin we call dis Video, Na so pipo dey hail di mutinying soldiers as dem reach di capital Bamako on Tuesday

Mali President Ibrahim Boubacar Keïta resign alias comot from office early mor mor on Wednesday wen e appear for goment television for di West African nation.

Mali president inside one broadcast also scata alias dissolve di goment and parliament.

"I no want blood to pour to keep me in power," im add.

Mali crisis

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Ibrahim Boubacar Keïta win second term in 2018

E dey happun just hours afta sojas bin arrest and detain oga Keïta and Prime Minister Boubou Cissé for di kontri biggest military camp near di capital Bamako.

President Ibrahim Boubacar Keïta and Prime Minister Boubou Cissé bin chop arrest around 4:30pm on Tuesday wey vex regional powers like di Economic Community of West Africa (Ecowas) and France.

Mali Crisis

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Sojs inside dis foto dey patrol for streets on Tuesday afta dem hear gunshots

"If today, certain elements inside our military alias armed forces want dis to end through dia intervention, I for really get choice?" Oga Keïta tok during im TV address.

Earlier, di sojas wey no gree obey orders of di authority alias 'mutinying soldiers' take control of di Kati camp.

Tori be say anger and vex don dey among group of sojas about dia pay and ontop di continuing fight with jihadists - add join di way many pipo no happi wit di former president.

Oga Keïta win a second term inside elections in 2018, but pipo don dey vex ontop corruption, anyhowness alias mismanagement of di economy and di rise of communal violence insidd areas of di kontri.

Map

Di way Keïta goment dey govern come lead to many large protests inside past months.

One new opposition coalition wey di conservative Imam, Mahmoud Dicko dey lead, don call for reforms afta rejecting adjustments from Mr Keïta, including di formation of a unity goment.

How pipo reaction been to Mali Crisis?

Wen news first break of di mutiny, the United Nations and African Union both call for di release of those wey sojas detain.

Mali Crisis

Wia dis foto come from, Presidency

Wetin we call dis foto, On 23 July, 2020 leaders of West African kontris bin do tok-tok for Bamako, to try settle di gbege wey dey happun inside Mali.

Di Economic Community of West African States (Ecowas), also tok say dia 15 member states don agree to close dia borders wit Mali, suspend all money wey dey flow to di kontri, and remove Mali from all of Ecowas' decision-making join- bodi.

Inside di past months, Ecowas get special messenger alias envoywey dey try settle between Oga Keïta goment and opposition groups.

Mali crisis

Wia dis foto come from, Presidency

Wetin we call dis foto, Ecowas envoy to Mali Goodluck Jonathan and President Muhammadu Buhari of Nigeria

Di UN Security Council go meet on Wednesday to discuss di latest developments inside Mali.

Mali former colonial ruler, France, also no waste time to condemn di president detention, and Foreign Minister Jean Yves Le Drian beg di sojas to return to barracks.

Mali na French speaking west African kontri we be key base for France sojas wey de fight Islamist insurgents across di Sahel region.