Mutiny: Mali coup 2020 na Col Sadio Camara, Col Malick Diaw, and Gen Cheick Fanta Mady Dembele dey behind resignation of President Ibrahim Keïta

Wia dis foto come from, EPA
Di Capone alias mastermind wey plan Mali coup 2020 wey pursue President Ibrahim Keïta from power on Tuesday include di deputy head of di kontri biggest military camp and one French-trained general.
BBC Monitoring give informate of three high-ranking military leaders wey dem feel say play ogbonge role for di coup.
1. Col Malick Diaw

Wia dis foto come from, EPA
Col Malick Diaw na di deputy head of di Kati camp wia di mutiny start.
Information about am no too dey plenti like dat apart from reports wey say e recently return from training inside Russia.
Oga Diaw stand next to Air Force deputy chief of staff Col-Major Ismael Wagué wey read one statement on Wednesday on behalf of di junta to announce di military takeover.
"We believe say Colonel Diaw na di leader of di mutiny for Kati camp, wey dey 15km [nine miles] from Bamakoi. E don first ask di president of di republic to leave power before 02:00 pm [1400GMT]," according to one tweet about am.
2. Col Sadio Camara

Wia dis foto come from, Other
Col Camara na former director of di Kati military academy.
Mali Tribune website report say dem born am for 1979 inside Kati, wey dey Mali southern Koulikoro region.
End of Di one wey oda users dey read well well
E graduate from di Koulikoro military academy with top honours. Dey com send am go northern Mali wia e serve under Gen El Hadj Gamou until 2012.
Col Camara later become di director of Kati military academy, one position wey im tanda until January 2020 wen e travel go Russia for military training.
Di newspaper, di Mali Tribune tok say oga Camara return to Bamako earlier dis month to take im one-month leave.
"Col Camara na pesin wey everybody appreciate well-well for wia im work and all im subordinates respect plus love am. To dem, e represent righteousness, seriousness and determination," di website write.
3. Gen Cheick Fanta Mady Dembele

Wia dis foto come from, EPA
Gen Cheick Fanta Mady Dembele na di director general of di Alioune Blondin Beye peacekeeping Institution.
Dem promote am to brigadier general for May 2018 and e come take over leadership of di peacekeeping institution for December 2018.
Before im appointment to di institution, Gen Dembele dey in charge of conflict management and strategic planning for di African Union Peace and Security Commission wey dey Addis Ababa, Ethiopia.
Gen Dembele na graduate of Saint-Cyr military academy for France. E aslo graduate from di General Staff College of Koulikoro, Mali. E get degree in history from di University of Paris I Panthéon-Sorbonne.
E also get master degree for civil engineering and graduate from German Federal Army University inside Munich.











