Buhari visit Bamako Mali: How Nigeria President Muhammadu Buhari first trip abroad since coronavirus pandemic go be

Wia dis foto come from, Bashir Ahmad
President Muhammadu Buhari of Nigeria wear facemask for di first time in public wen e arrive di Malian capital Bamako on Thursday afternoon for one-day tok-visit.
Di president visit dey follow toks wit former Nigerian President Goodluck Jonathan, wey be one of di Ecowas mediators wey travel to Mali to go settle mata.
Some West African leaders, like Nigerien President Mahamadou Issoufou, don agree to meet for Mali for talks to settle di fight-fight between Mali President Boubacar Keita and di opposition.
Ghanaian President Nana Akufo Addo and Cote d'Ivoire's Alassane Ouattara suppose dey to attend di toks.

Wia dis foto come from, Bashir Ahmed/Twitter
How Buhari first trip abroad since coronavirus pandemic go be
Garba Shehu, di special assistant to President Buhari, tell BBC say di ECOWAS leaders wan go hold toks wit di Malian side afta former Nigerian President Goodluck Jonathan delegation no gree find solution to di crisis.
He tok say di presence of di leaders fit help solve di crisis- "perhaps dia status as di West African leaders go make dem listen to dem and ensure peace for Mali".

Wia dis foto come from, Buhari Sallau

Dis na di first time wey Nigerian President Muhammadu Buhari go comot from Nigeria since dem don close di kontri border due to coronavirus pandemic.
End of Di one wey oda users dey read well well
In di past citizens don complain say about di president travels upandan.

Wia dis foto come from, Twitter/ Muhammadu buhari
Former Nigerian President Goodluck Jonathan on Monday pay courtesy call on President Buhari for im villa for Abuja, wia dem hold private meeting.
Buhari's Twitter account reveal say Jonathan visit Aso Rock Villa to report on di political crisis resolution mission wey ECOWAS send dem to Mali last week.
"I don receive report from Ecowas' special envoy to Mali, former President Goodluck Jonathan, on di political crisis wey dey happun for Mali and we go ask di group president, di President of Niger, to give us full account of im presidency," Buhari tok.
















