Mali crisis: Weti Mali and Cameroon get in common?

Wia dis foto come from, EPA
As army seize pawa for Mali, force President Ibrahim Boubacar Keita for resign, quick reaction from international community make Cameroonians tok.
African Union, United Nations and kontris laik France react, condemn army take over. Economic Community for West African States, ECOWAS tok sanctions.
Some Cameroonians for social di wanda why dey no fit react de same way for de Anglophone crisis weh e di worse since 2016.
Dis same Ibrahim Boubacar Keita bin di torture de population deh no react, just laik deh di look Cameroon killings no di act, Cameroonians react.
Others di look na France and e relation wit it former colonies, say make France komot eye from affairs of kontris laik Mali, Cameroon, Gabon.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Some say nothing go stop people pawa, di suggest say afta Mali, Cameroon and oda kontris go follow.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 3
But some like Prof. Claude Abbe say de situation for Mali bi different. International community fit react quick because Mali na junction weh oda kontris di use for smuggle goods to Europe and Asia. But for Cameroon, na internal crisis and international community di react for dia own way.
Mali crisis and Cameroon own similar?
Make we break am down
End of Di one wey oda users dey read well well
For Mali, opposition bin di ask for reforms, pipo komot for street march for about three month for condemn bad goment, corruption, pikin dem nova go school for about seven years, but international community no shake eye.
Na de same for Cameroon, lawyers and teachers bin want change for follow Anglo-Saxon way for run legal system and education. Anglophone crisis don enta four years today, pikin dem nova go school for four years, international community di tok, but concrete action no dey.
Military
Military for Mali bi na independent institution, so president no bi fit control de army, reason why deh bi try for take pawa before and success for April 18.
Cameroon military dey under President Biya e ampit, deh di pay big army officials well so dey di obey goment. President Biya na de first commander in Chief of de armed forces and e get most tight security for Africa.

President Buhari contribution
Buhari, Nigerian President don go Mali for try for solve de problem two taims. Buhari hold meeting for tok about Mali before de coup.
But many di wanda why e nova try for helep e close neighbour for solve de crisis for Cameroon.
Presidents Biya and Buhari get long taim relationship weh e start for 1986. Cameroon and Nigeria get diplomatic agreements and e hard for Nigeria for just react. Some say Nigeria and Cameroon di fear make secessionist for Nigeria and Cameroon join hands.
France and former colonies
France still get strong grip for former colonies, dia military dey Mali and Cameroon, deh di maintain long serving leaders for pawa for economic gains, Mali, Cameroon Gabon. De kontris di still pay colonial tax and keep dia moni for French treasury.













