Edo Election: Obaseki na winner of Edo election governorship poll

Govnor Godwin Obaseki

Wia dis foto come from, Godwin Obaseki

Read am in 2 mins

Nigeria election joinbodi, di Independent National Electoral Commission, INEC, don declare Govnor Godswin Obaseki, di candidate of di Peoples Democratic Party (PDP), di winner of di 2020 govnorship election for Edo State, southern part of di kontri.

Obaseki get 307,955 votes while im opponent Osagie Ize-Iyamu, wey be candidate of di All Progressives Congress (APC) come second with 223,619.

Dis victory go secure Obaseki seat for di goment house for anoda four years as im go be govnor for di second time.

Obaseki dump APC before di election afta di party disqualify am. E go on to win di govnorship ticket under PDP to contest for second term in office.

For 2016, Ize-Iyamu contest under di platform of di PDP but e lose to Obaseki wey contest under APC dat year.

See how pipo vote

How Edo pipo vote

I dey study di election result - Ize Iyamu

Di APC govnorship candidate for di 2020 Edo governorship election Pastor Ize-Iyamu say e dey study di results wey INEC announce and go announce e next move soon.

Ize-Iyamu wey thank and appreciate im supporters, say dem endure many evils including say dem no fit vote freely.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Buhari congratulate Obaseki

President Muhammadu Buhari don hail di election process for Edo State wey lead to di victory of Governor Godwin Obaseki wey di Independent National Electoral Commission (INEC) declare.

Di President congratulate di winner and ask am to show grace and humility in victory.

Obaseki and Buhari

Wia dis foto come from, Godwin Obaseki/Twitter

For im reaction to di outcome of di election wey INEC announce, President Buhari say: "My commitment to free and fair elections dey gidigba, because without free and fair elections, di foundation of our political and moral authority go dey weak." Di President add: "I don consistently advocate for free and fair elections for di kontri because na di bedrock of true democratic order.

"Democracy go mean nothing if di votes of di pipo no count or if wuru-wuru enta dia mandate."

He commend di pipo of Edo State, di parties, candidates and security agencies say dem conduct demsefs responsibly.

How pipo celebrate Obaseki victory for Benin

Many pipo enta streets for Benin to celebrate as INEC declare Obaseki winner.