Edo Election final result 2020: Obaseki na winner of Edo State election governorship poll - See how pipo vote
Godwin Nogheghase Obaseki of Peoples Democratic Party win di Edo Election final result 2020 afta e defeat im closest challenger Osagie Ize-Iyamu of All Progressives Congress, according to official results from Nigeria election office, Independent National Electoral Commission (INEC).
Just click on di map of each local goment to see di party wey win and how pipo vote.

"Edo Governorship Election final result 2020" - See breakdown of how pipo vote
Di returning Officer for Edo Governorship election, Prof. Akpofure Rim-Rukeh don give summary of di entire votes wey dem cast during di 19 September, 2020 election below:
Accredited voters: 557,443
Valid votes: 537,407
Rejected votes: 12,835
Total votes cast: 550,242
APC: 223,619
Skip Di one wey oda users dey read well well and continue reading
Di one wey oda users dey read well well
End of Di one wey oda users dey read well well
LP: 267
PDP: 307,955
SDP: 323
















