Remembrance Sunday: UK dey honour victims for war
Everywhere for United Kingdom dey quiet for two minutes, as di country dey honour those wey don die for war.
Politicians, members of di Royal Family, former soldiers wey be veterans and even ordinary country people join to observe dis silence across di country, and dem put flowers plenty-plenty for different ceremony.
Prince Charles na im attend dis year ceremony for di Cenotaph inside London and di special clock for UK wey bi Big Ben ring for 11:00 GMT.
Countries all over di world do Remembrance Day, or Armistice Day to remember di over seventeen million soldiers and civilians wey die for World War One.
Di British Prime Minister Theresa May, other senior politicians, religious leaders and big-big ogas and madam dem join di royal family.

Wia dis foto come from, PA

Wia dis foto come from, AFP

Wia dis foto come from, Reuters

Wia dis foto come from, MOD
For Scotland, e pass 100 wreaths of flower wey dem lay for Edinburgh dia City Chambers. First Minister Nicola Sturgeon attend di service.
Inside Wales, dem hold service for di Welsh National War Memorial, and one field of remembrance for Cardiff Castle get more than 10,000 crosses.
At di Cenotaph for Enniskillen for Northern Ireland, Irish Taoiseach Leo Varadkar lay one green laurel wreath, 30 years after one IRA bombing for there kill 12 people.
End of Di one wey oda users dey read well well
Meanwhile, dem dey find bell ringers for 2018 to honour di 1,400 ringers wey die inside World War One.

Wia dis foto come from, PA

Wia dis foto come from, PA
Sir Stuart Peach, wey be di chief of di defence staff, tell di Andrew Marr show say "today we dey mark and remember over a million British and Commonwealth soldiers wey die for both world wars....e also dey very important to understand say dis na about reconciliation. Dat nations must move on."













