Gaza hospital: Wetin video, pictures and oda evidence tell BBC verify about Al Ahli hospital blast

Wia dis foto come from, Reuters
- Author, Paul Brown, Joshua Cheetham, Sean Seddon and Daniele Palumbo
- Role, BBC Verify
One deadly blast for di crowded Al-Ahli hospital for Gaza City dey feared to don kill hundreds of pipo.
Di Hamas-controlled Palestinian authorities for Gaza wey immediately blame Israel, claim say na deliberate air strike. Israel don deny say dem get hand for di incident.
For middle of di claim and counter-claim, to get to di truth dey harder dan ever.
BBC Verify dey try unravel wetin dey and no dey known - look video footage, still imagery and oda evidence, including eyewitness accounts. To add, one BBC journalist don go di blast site, wia limited access dey.
New informate dey show all di time, so we go kontinu to update dis article as we learn more and tok to experts about di evidence.
E also dey important to note say as well as di physical fighting, dis fight-fight dey play out as information war. Dis no be di first time authorities for Israel and Gaza don give completely different accounts of one explosion. We dey also look dia different claims and statements.
Di blast
Di explosion for di hospital bin happun around 19:00 local time on Tuesday. One 20-second video wey bin circulate for social media wey claim to show di blast na di first ogbonge piece of visual evidence to come out of di incident.
Inside am, you fit hear di whistling sound of one incoming projectile, follow wit explosion and one big fire.
End of Di one wey oda users dey read well well
Live video from di Al-Jazeera media network bin air for 18:59 local time bin show as one bright light dey rise for di skies above Gaza. E bin flash two times bifo e drastically change direction, and den explode. One explosion den show as e go off di ground far away, e dey followed by one much larger explosion wey dey closer to di camera operator, wey we geolocate.
Some commentators don suggest say na from one rocket wey show to explode or disintegrate.
Oda video wey show for social media channels bin show wetin look like di same blast from different angles and distances.
We bin reach out to ova 20 tink tanks, universities and companies wit weapons expertise. Nine of dem neva respond to us and five no go comment, but we bin speak to experts for di remaining six.
We bin ask whether di available evidence - including di size of di explosion and di sounds dey heard beforehand - dem fit use am to determine di cause of di hospital blast.
So far di findings dey inconclusive. Some experts wey we tok to say e no dey consistent wit wetin you go expect from typical Israeli airstrike wit one large munition.
J Andres Gannon, one assistant professor for Vanderbilt University, for di US, say di ground explosions show to dey small, e mean say di heat wey generate from di impact fit be cause of leftover rocket fuel rather dan explosion from one warhead.
Justin Bronk, one senior research fellow for di UK-based Royal United Services Institute (Rusi), agree say. While e dey difficult to dey sure for dat early stage, e say, di evidence look like di explosion dey caused by one failed rocket section hit di car park and cause fuel and propellant fire.
Oga Gannon say e no dey possible to determine from di footage whether di projectile strike im intended target.
Visual evidence from di blast site
Di BBC dey able to match details of buildings and di layout of di Al Ahli hospital site wit publicly available satellite imagery, to establish di hospital be di scene of di blast.
Based on available evidence, e show say di explosion bin happun for one courtyard wey be part of di hospital site. Images of di ground afta di blast no show significant damage to surround di hospital buildings. Wetin di images show includes scorch marks and cars wey don burn.

Na di Anglican Church get and dey run di hospital.
Canon Richard Sewell, di dean of St George College for Jerusalem, bin tell BBC say about 1,000 displaced pipo bin dey take shelter for di courtyard wen e dey hit, and about 600 patients and staff bin dey inside di building.

Wetin BBC reporter find
BBC reporter Rushdi Abualouf don go di Al Ahli Hospital. Witnesses dia report scene of wreckage, and say dem still dey collect deadi body dem.
One man bin tell am say women, children and elderly pipo bin dey di hospital wen di explosion happun.
We still dey analyse images and footage of di victims to determine wetin dem fit tell us about di blast from di nature of dia injuries.
Wetin we no know yet
One of di most critical pieces of evidence na di nature of di crater wey di explosion leave behind.
Di Israel Defence Forces (IDF) say di absence of large crater, or blast damage to adjacent buildings, prove say di explosion no dey caused by dia weapons.
You fit see one small crater and we dey see if any of di oda marks represent oda craters.

Anoda important part of missing evidence na missile fragments. Projectiles often dey identifiable by di wreckage of dia shell, and dey fit dey used to determine di projectile origin. But for dis case, we neva see dat evidence.
Di IDF don release one recording of wetin dem say be intercepted conversation between two Hamas militants wey acknowledge say di hospital bin dey hit by projectile Palestinian Islamic Jihad (PIJ) fire. PIJ na di second largest militant group for Gaza, and support Hamas 7 October attack on Israel.
E no dey possible to independently verify dis recording. For one statement, PIJ bin deny say dem get hand for di incident and blame Israel for di blast.
Additional reporting by: Tom Spencer, Shayan Sardarizadeh, Emma Pengelly and Jamie Ryan















