BRT kidnap in Lagos: Bamise Ayanwole mama say 'Bad pipo don break my backbone'

Bamish and her mama

"I don struggle all my life. See di kain place me and my husband dey live. But I no worry because I know say my children go helep us as dem don grow. Now wey time don dey reach to reduce dis our suffering dem don kill one of dem."

Na wetin Ayanwole Comfort, di mama of 22-year-old Bamise Awanwole wey miss for Lagos state goment owned BRT bus and wey dem later find dead tell BBC Pidgin as she react to di death of her pikin.

"I no born my pikin for anybody to use am do money ritual. Na struggle she dey struggle so dat she go fit survive as we her parents no get money.

She no dey don anything illegal because na work she dey learn. She just graduate from di first place she dey do fashion designing. In oda to improve herself she decided to go anoda place go to learn. Na struggle she dey struggle and now dem don kill am. Bad pipo don break my backbone." Madam Comfort tok as she dey cry.

Tori of di death of Bamise dey trend for Nigeria as pipo dey call for justice. Bamise bin miss for about a week before di tori enta public space and before dem find her dead.

Wetin we call dis Video, Justice for Tina: 'She be 17 going on 18 and bin get many dreams'

'I dey helpless'

Bamise mama wey dey call for justice remember di last time she see her pikin, she say she no believe say she no go ever see her pikin again.

"E neva reach three weeks wey she buy her new phone. Di phone she dey use before no good and she just struggle buy her new phone wey she neva even pay finish. Wetin for happun if to say she get dis phone. We for no know wetin kill am.

Bamishe mama
Wetin we call dis foto, Bamishe mama dey broken by di death of im pikin

I no believe say I no go see my daughter again. She chop my food di last time she visit me. I no know na di last time I go feed my pikin be dat.

I dey helpless except God come down to help me. Make goment also come help me. Di goment of Lagos and Ekiti wey I come from. Make dem come help me because we no get anybody to help seek justice for dis mata.

Wetin we call dis Video, Sylvester Oromoni wey die afta dem allegedly beat am sake of e no join cult tok how e die

Goment fail my pikin - Bamise papa

For Bamise papa, goment don fail im pikin becos di bus wey she enta na goment bus wey suppose like dat no suppose happun.

"We wey be poor pipo for society dey only rely on wetin goment give us. Na so we dey take survive for many years. Goment bring bus say make we enta. We enta finish come still dey die.

If goment bus no dey safe again wetin we go come begin do. See as dem kill my pikin. Goment don first fail her because dem fit provide her di education wey she want. Now dem no fit guarantee her safety. She die inside goment property. " Bamise papa tok.

Di papa say dem want justice.

"My own be say make president Muhammadu Buhari and governor Babajide Sanwo-Olu join body to make sure say dem arrest all di pipo wey get hand for my daughter death. If dem no do anytin na God go judge dem.

Bamise family dey ask di goment for justice
Wetin we call dis foto, Bamise family dey ask di goment for justice

Pipo don begin fear to enta BRT Bus because of dis tin wey happen. Na di way dem handle am go determine how Nigerians go see dem" E tok,

Meanwhile, Bamise sister also describe her as good girl wey no deserve to die.

"Goment don fail us," na so di elder sister Omilana Ruth tok.

Di Lagos state police confam di death of Bamise on 7 March, one week afta she bin go missing wen she enta BRT bus.

According to di police, "We see di deadi bodi dey lie on top Carter Bridge by Ogogoro Community, Lagos Lagos Island. Di corpse dey for morgue for Mainland Hospital, Yaba, for autopsy."

Tori be say di driver of di Lagos state Bus Rapid Transit System allegedly kidnap Oluwabamise Ayanwole.

And di Police follow drop statement say dem don arrest di BRT driver wey dem suspect get hand for di death.

Adekunle Ajisebutu, tok-tok pesin for di Lagos state Police Command confam dis one to tori pipo.

Police bin say dem begin investigate di disappearance of di lady wey miss since 26 February.

'Bamise na good girl'

Di missing girl

Wia dis foto come from, Foto wey police release

Former oga of di lady wey die, Madam Oni say Bamise na good girl.

She tell BBC Pidgin say Bamise learn under her for more dan three years - and she graduate for September 2021.

According to di madam, Bamise bin get wia she dey work for Lekki wia she plan to upgrade wetin she don learn before.

"Even wen she wan enta dat BRT bus she no dey sure and dat na why she call her friend to ask if dem dey take BRT for Chevron.

We dey very surprise say she miss because Bamise no be girl wey dey waka anyhow. Na very good girl. As we no see am dat last week Sunday naim we begin ask everybody wey we know her before her friend come send us all dia chats.

"Wen we reach police station dem tell us to identify her and afta dat dem reveal to us say di kidnappers cut off some body part of Bamise. Di next morning na im we go see her deadi body for mortuary." she tok.

Bamise papa
Wetin we call dis foto, Bamise papa say goment fail im pikin

How e allegedly happun

According to di police, di incident allegedly happun on 26 February, 2022 wen Bamise board di BRT bus from Chevron bus stop, Lekki for Lagos, South West Nigeria. Di BRT bin dey go Oshodi around 7:00pm in di evening.

Di young lady wey be fashion designer also do video wit her friend wen she sense say some tin wan happun to her.

For di video wey she do wia she speak Yoruba she say, "na three men and one woman dey inside di bus. Di woman sidon for back."

Zooming-in di phone camera she say "dat na di number of di bus just in case. Please pray for me."

Still for di video di friend wey she tok to advise am to come down for Oworonshoki but nobody know wetin happun afta dat time.

Wetin Lagos state goment tok?

Lagos state Govnor Babajide Sanwo-Olu don send condolence message to Bamise family as e assure say dem go chook eye well-well inside di mata as di life of al citizens of di state mata.

"We go therefore leave no stone unturn in di investigations and arrest of everyone wey get hand for di kidnap and death of Miss Oluwabamise Ayanwole.

Bamishe sister

Di driver of di BRT bus wey involve for di unfortunate incident don dey arrested, and di management of Lagos Bus Service Ltd don get order to cooperate fully with security agencies in dia investigations, so dat di full weight of di law go come down on everyone wey involve for dis ugly incident." Statement wey Sanwo-Olu sign tok.

Oda cases of pipo wey don miss and dem later find dead

Cases of kidnap don dey on di rise for di kontri and security agencies don make many arrests recently.

Di three boys include two teenagers and anoda wey dey 20 years.

Hanifa Abubakar

Hanifa

Wia dis foto come from, other

Di suspects ontop di alleged murder of Hanifa Abubakar dey face murder charges for court for Kano state.

Dem dey on trial for allegedly kidnapping and killing Hanifa after police discover her deadi bodi inside Northwest Preparatory school for Kano city.

Na January Nigeria Police arrest three suspects including Abdulmalik Tanko over di kidnap and murder of Hanifa.

"After e give her poison e wait 20 minutes outside for Hanifa to die," authorities quote di prime suspect confession.

Iniobong Umoren

Iniobong Umoren wey die

Wia dis foto come from, Umoh Uduak

Anoda case na dat of Happiness Iniobong Umoren wey disappear for for days before dem discover say she don die.

On 29 April @UmohUduak begin use #HinyNumoren to announce say her friend dey in trouble and she need help.

Uduak wey her twitter handle be Happiness Activist say her friend tell her say she dey go for one job interview for Airport road on April 29th, and she no return since then.

Dem later put her for University of Uyo Teaching Hospital UUTH pending autopsy.

Dis no follow for di plenty report of kidnapping wey dey happun often for different part of di kontri.

Justice for Bamise

Pipo don begin protest di death of Bamise and call for justice.

For social media, di hashtag #JusticeforBamise don begin trend.

Social media influencer react via twitter post

Wia dis foto come from, Twitter

Social media user react

Wia dis foto come from, Facebook

Social media user react

Wia dis foto come from, Twitter

Some users call out di management of di Lagos Bus Rapid System (BRT) over dia failure to trace di driver of di bus wey Bamise enta.

Odas also dey also blame police say dem no act fast to stop di death of di lady.

Lagos Bus Rapid Transit System (BRT)

Wia dis foto come from, BRT

Wetin be BRT?

Lagos Bus rapid transit system (BRT) na transport scheme for Nigeria commercial city.

Goment roll-out di BRT transport scheme for 2008 sake of di increasing population for di state.

According to goment di introduction of di BRT scheme na to fit provide alternative transportation for di state and to also decongest di roads.

Na Lagos Metropolitan Area Transport Authority (Lamata) wey dey under di Ministry of transport dey manage di BRT.