#FindHinyHumoren: Iniobong Umoren wey disappear for Akwa Ibom no dey alive again

Wia dis foto come from, TWITTER
Police say dem still dey torchlight mata of one Happiness Iniobong Umoren wey disappear for four days now.
Na on Thursday wey her friend Umoh Uduak wey bin first cari the mata come Twitter, come announce on Sunday say "my friend (Umoren) no dey alive again ".
Di Police tok-tok pesin for Akwa Ibom Odiko MacDon tell BBC Pidgin say dem still dey tidy up loose ends and go soon release statement.
But for Twitter, her friend say Umoren don die and pipo don dey post videos and oda tori wey concern her death.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Uduak, wey dey use di handle @UmohUduak for Twitter and who raise di alarm of her disappearance, tell di BBC: "Dem don kill my friend and dem don bury my friend," as heavy cry full her mouth.
Di Nigeria Police bin confam one day before on 1 May confam di arrest two pipo wey involve for di disappearance of Ms Umoren.
Wetin happun?
On 29 April @UmohUduak begin use #HinyNumoren to announce say her friend dey in trouble and she need help.
Uduak wey her twitter handle be Happiness Activist say her friend tell her say she dey go for one job interview for Airport road on April 29th, and she no return since then.
End of Di one wey oda users dey read well well
She say di interview venue dey very far from her house.

Wia dis foto come from, TWITTER
She add join say she bin send her one second audio record and as she try call her back, na her scream she hear.
@HinyHumoren wey call hersef Iron_Lady for Twitter describe hersef as pesin wey dey Pragmatic Humanist, Choleric-melancholic, Skin Care products formulator, Philosopher, Lover of people wit sense.
For her pinned post on Twitter wey she post on April 27, she say she dey find work.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Plenty twitter users don chook mouth to find her.

Wia dis foto come from, Twitter

Wia dis foto come from, TWITTER













