Bamise BRT murder: Three tins wey don happun so far with di case of di alleged kidnapping and death of 22-year-old Oluwabamise Ayanwole

Oluwabamise and BRT foto collage

Wia dis foto come from, Oluwabamise/BRT

Reactions still dey follow di death of 22-year-old Bamise Ayanwole, wey dem delcare dead afta she miss wen she enta Lagos state goment Bus Rapid Transit, BRT bus.

Bamise bin miss on 26, February 2022 afta she board BRT from Chevron area Ajah wey dey go Oshodi before police discover her remains and declare her dead.

Since den, Nigerians don dey react as her family call for justice.

Bamise family call for justice

Bamise mama wey dey call for justice remember di last time she see her pikin, she say she no believe say she no go ever see her pikin again.

"E neva reach three weeks wey she buy her new phone. Di phone she dey use before no good and she just struggle buy her new phone wey she neva even pay finish. Wetin for happun if to say she get dis phone. We for no know wetin kill am.

I no believe say I no go see my daughter again. She chop my food di last time she visit me. I no know na di last time I go feed my pikin be dat.

I dey helpless except God come down to help me. Make goment also come help me. Di goment of Lagos and Ekiti wey I come from. Make dem come help me because we no get anybody to help seek justice for dis mata.

For Bamise papa, goment don fail im pikin becos di bus wey she enta na goment bus wey suppose like dat no suppose happun.

"We wey be poor pipo for society dey only rely on wetin goment give us. Na so we dey take survive for many years. Goment bring bus say make we enta. We enta finish come still dey die.

If goment bus no dey safe again wetin we go come begin do. See as dem kill my pikin. Goment don first fail her because dem fit provide her di education wey she want. Now dem no fit guarantee her safety. She die inside goment property. " Bamise papa tok.

Di papa say dem want justice.

"My own be say make president Muhammadu Buhari and governor Babajide Sanwo-Olu join body to make sure say dem arrest all di pipo wey get hand for my daughter death. If dem no do anytin na God go judge dem.

Ayanwole Bamise and Govnor Babajide Sanwo-Olu

Sanwo-olu react

Lagos state goment say dem no get any plan to cover-up di investigation concerning di killing of late Ayanwole Bamise, di 22-year old fashion designer.

Govnor Babajide Sanwo-Olu tok dis one wen e dey yan wit tori pipo on Tuesday, say goment no go fit cover up any tin wey concern di killing of Ayanwole Bamise wey miss afta she enter BRT bus for February.

"E dey unfortunate. And I don see how pipo dey react and some pipo dey extremely sensational say I wan cover up dis mata. I no go fit do dat kain tin.

Our own for dis mata na to ensure transparency on dis mata and whoever dem catch go face di full wrath of di Law," di Sanwo-Olu tok.

Di govnor tell tori pipo say di state security pipo bin arrest di BRT bus driver wey bin carry Bamise di night wey she disappear for anoda state.

"Na because we get interest for di mata make we deploy more security to join police for di investigation. Na dat one lead to di driver arrest for anoda state."

E also condole Bamise family say: "We condole wit di family of one our citizens, Bamise wey die. We go make sure say we dey open wit di investigation."

Collage of di late Bamise and arrested BRT driver

Wia dis foto come from, Facebook/TVC

BRT bus driver deny involvement

Di driver for one video wey go viral wash hand comot di death of Bamise.

For inside video wia one tori pesin dey ask am question for wia dem detain am, di driver of di BRT bus wey still dey in im dark and sky blue driver uniform wey dey crested wit Lagos state logo tok wetin happun dat night.

"Why I run sir? Wen those guys show me di weapon as I was saying sir, I no fit be myself anymore. I become afraid, so whatever di man on gun tell me to do na im I dey do. Wen I follow dat Carter Bridge, afta dat overhead bridge, dem order me to stop dia, and wen dem order me to stop, dem say make I open di door, wen dem come down, dem come start to dey drag her down.

Wen I see say she dey cry for help, actually, I dey helpless. So I bin dey tink say she dey inside di vehicle, holding di iron, so I move on, I leave her for dat scene, I never know say dem drag her down already. I no get connection wit anyone of dem, e bin just passenger, I no get connection wit dem." Di driver tok.

Tori be say di driver of di Lagos state Bus Rapid Transit System allegedly kidnap Oluwabamise Ayanwole.

How e allegedly happun

According to di police, di incident allegedly happun on 26 February, 2022 wen Ayanwole board di BRT bus from Chevron bus stop, Lekki for Lagos, South West Nigeria. Di BRT bin dey go Oshodi around 7:00pm in di evening.

Di young lady wey be fashion designer also do video wit her friend wen she sense say some tin wan happun to her.

For di video wey she do wia she speak Yoruba she say, "na three men and one woman dey inside di bus. Di woman sidon for back."

Zooming-in di phone camera she say "dat na di number of di bus just in case. Please pray for me."

Still for di video di friend wey she tok to advise am to come down for Oworonshoki but nobody know wetin happun afta dat time.

Adekunle Ajisebutu, tok-tok pesin for di Lagos state Police Command confam dis one to tori pipo.

Di command bin confam di death of Bamise for earlier statement.

According to di police, "We see di deadi bodi dey lie on top Carter Bridge by Ogogoro Community, Lagos Island. Di corpse dey for mortuary for Mainland Hospital, Yaba, for autopsy."

Lagos Bus Rapid Transit System (BRT)

Wia dis foto come from, BRT

Cases of kidnapping don increase

Cases of kidnap don dey on di rise for di kontri and security agencies don make many arrests recently.

Recently three boys for Ogun State chop arrest after dem allegedly kill dia friend girlfriend for money ritual.

Di three boys include two teenagers and anoda wey dey 20 years.

Dis no follow for di plenty report of kidnapping wey dey happun often for different part of di kontri.