Timothy Adegoke murder: Third witness tell court say ‘Hotel staff take oath of secrecy, manipulate lodging document’ to hide di mata

Wia dis foto come from, others
More tori don come out over di alleged killing of Timothy Adegoke.
Dis na as di trial of di owner of Hilton Hotel and Oduduwa University Ile-Ife, Dr. Rahmon Adedoyin and six odas enta day two.
Di defendants dey face 11 count charge wey include murder - but dem don plead not guilty.
Adegoke, wey be Master student of Obafemi Awolowo university, Ile-ife wey dem allegedly die for di Hilton Royal Hotel, Ile-Ife.
Police make revelation
For di latest development, one police detective, Inspector Afeez Olaniyan - di third witness for di matter - during cross examination say afta dia investigation dem find out say late Timothy Adegoke actually lodge for Hilton Royal hotel, Ile-ife on 5 November, 2021.
Olaniyan say dem discover di deadi bodi of Timothy Adegoke on 6 of November, 2021.
E add say dem unlawfully remove di deadi bodi from di hotel and later dump am along Ede road, Ile-ife
According to di police officer, "Im (Aderogba) tok say Magdalena tell am to bring di spare key to di room and wen dem enter dem open di room wia lifeless body of di guest dey ontop bed.
End of Di one wey oda users dey read well well
"E say dem call di chairman, Dr. Rahmon Adedoyin and tell am about wetin happun.
"Afta sometime Raheem Adedoyin, di son of di chairman and di receptionist, one Easter and Kazeem Otetunde come join dem.
"E say Raheem carry dem go one office wia dem take oath wit di Bible say make dem keep am secret.
"Around 11pm im sef (Aderogba), Raheem, and Kazeem carry di deadi body from di room go Ede road wit di tins wey e carry come including, laptop, phone and money and dump am by di roadside"
Inspector Afeez Olaniyan say as part of dia plan to cover up wetin happun some members of staff of di hotel do mago-mago wit di hotel documents wey dem later recover from one of di defendants, Adesola Adedeji mobile phone.
Justice Adepele Ojo adjourn di trial to 16, 17 and 18 of March 2022 for continuation of trial.
Police begin trial of di case
Di Osun State high court on Monday 7, March refuse di bail applications for Rahmon Adedoyin and seven odas wey dey charged in di murder case of Timothy Adegoke, one master student of Obafemi Awolowo university, Ile-ife wey dem allegedly kill for di Hilton Royal Hotel, Ile-Ife.
Di presiding judge wey be di chief judge of Osun state, Justice Adepele Ojo for her ruling refuse dia bail applications base on di nature of di case and on di ground say di correctional centre get all di necessary facilities to cater for those wit medical conditions wey dey "not critical".
Di owner of Hilton Hotel and Oduduwa University Ile-Ife, Adedoyin and six odas dey face 11 count charge wey include murder wey dem don plead not guilty too.
Dem bring di suspects come court on Monday wen di trial also begin from Ilesa Correctional Facility wia dem bin order make dem dey remanded.
Di wife and broda of di late Adegoke also bin dey court.
Who be Timothy Adegoke and wetin happun to am
Before im death, Timothy Adegoke na postgraduate student of Obafemi Awolowo University, Ile Ife.
Di 37-year-old man wey dey live for Abuja bin travel to Ile Ife on November 5, 2021, to write one examination for di school distance learning centre for Moro, Osun State.
Adegoke family declare am missing afta dem no fit reach am and e no show up for di exam wey e go write for di school.
Police find Adegoke deadi bodi about one week afta dem declare say di man dey miss. Dem arrest di owner of di hotel wia Timothy Adegoke bin lodge before dem declare am missing.

Wetin else don happun so far
Tori be say dem declare Timothy Adegoke missing on November 7
Adegoke, wey be Abuja-based student, bin travel to Ife on November 5 to write one examination for di school distance learning centre for Moro, Osun State
Im family and friends begin worry wen dem no fit reach am and as e no show to write di exam.
Police find di deadi bodi of Timothy Adegoke, about one week afta dem declare say e dey miss
Police arrest Dr Rahman Adedoyin, owner of di hotel wia Adegoke bin lodge before e miss and six oda suspects ontop di mata.
Who be Dr Rahman Adedoyin, di main suspect for di case?
Dr Rahman Adedoyin na di owner of di hotel, Hilton Resorts wia Adegoke bin lodge.
E be educationist and businessman wey be di founder and proprietor of Oduduwa University and The Polytechnic, Ile-Ife.
Dem born Rahmon Adedoyin into royal family for di ancient city of Ife in Osun State.
Na for Osun state e complete im primary and secondary school education before e proceed to University of Ife (now Obafemi Awolowo University) wia e obtain a Bachelor of Science degree in 1983 afta e study Mathematics Education.
E get im doctorate degree for 1996 from All Saints University School of Medicine, New York City.
E also be fellow of di Nigerian Institute of Industrial Statisticians.
E dey stand trial alongside six odas , Adedeji Adesola, Magdalene Chiefuna, Adeniyi Aderogba, Oluwale Lawrence, Oyetunde Kazeem, Adebayo Kunle, for di murder of Timothy Adegoke.










