Nato countries: What is Nato and why Sweden wan join?

Turkish President Tayyip Erdogan and Swedish Prime Minister Ulf Kristersson shake hands next to NATO Secretary-General Jens Stoltenberg before dia meeting, on di eve of one NATO summit, for Vilnius, Lithuania July 10, 2023

Wia dis foto come from, Rex Features

Wetin we call dis foto, Turkish President Tayyip Erdogan and Swedish Prime Minister Ulf Kristersson shake hands for di Nato summit for Vilnius

Dis na historic moment for Sweden, wey use last year fight hard so dat dem go dey accepted into Nato.

Di Nordic kontri bin previously embrace wartime neutrality for more dan 200 years, but apply for membership last May as part of efforts to improve security and stability for northern Europe, following Russia invasion of Ukraine.

However, until late on Monday night, na Turkey bin dey block Sweden application.

Turkey bin argue say Sweden dey give refuge to Kurdish militants, and e need to do more to crack down on rebel groups like di Kurdistan Workers' Party (PKK), wey e consider a terrorist organisation.

Di EU and US don also label di PKK as a terrorist group.

Like oda Nato 31 member kontris, Turkey get di power to block new nations from joining di group.

Di outcome of crunch toks wit President Recep Tayyip Erdogan dey seen as a major win for Sweden right-wing Prime Minister Ulf Kristersson.

Oga Kristersson wey bin first start di application process for Sweden to join Nato say di kontri don address Turkey concern about terrorism.

Sweden don introduce tougher anti-terrorism laws for June, wey don make am illegal to give financial or logistical help to terrorist groups.

Wetin be Nato?

Nato - di North Atlantic Treaty Organization - na military collabo wey bin dey formed for 1949 by 12 kontris wey include US, Canada, UK and France.

Di koko behind di collabo na say members gree say dem go help if one member come under armed attack.

Di aim first first na to come against di threat say post War Russia go wan expand for Europe.

For 1955, Soviet Russia too start dia own military collabo for eastern European communist kontris wey dem wey dem call di Warsaw Pact.

Afta di fall of di Soviet Union for 1991, some former Warsaw Pact kontris do about turn to follow Nato.

E currently get 31 members across Europe and North America.

Graph show Finland and Sweden armed forces

Why Sweden wan join Nato, and why Turkey dey agree now?

Sweden and Finland both bin apply to join Nato for April 2022, two months afta Russia invade Ukraine, because dem fear say Russia dey become increasingly aggressive.

Na Turkey and Hungary bin initially refuse to approve Sweden membership. Turkey accuse Sweden say e dey host dia enemies, including pro-Kurdish groups.

However, Nato secretary-general Jens Stoltenberg tok say Sweden don address "Turkey legitimate security concerns now", e add say Turkish goment go soon ask dia parliament to approve di kontri application.

E say Hungary goment don also promise to do di same.

However, e neva clear wen di two kontris' parliaments go hold dia votes, or wen Sweden go officially become part of Nato.

Together, Sweden and Finland go support Nato forces by more dan 280,000

NATO member kontries list

  • Albania
  • Belgium
  • Bulgaria
  • Canada
  • Croatia
  • Czech
  • Republic
  • Denmark
  • Estonia
  • Finland
  • France
  • Germany
  • Greece
  • Hungary
  • Iceland
  • Italy
  • Latvia
  • Lithuania
  • Luxembourg
  • Montenegro
  • Netherlands
  • North Macedonia
  • Norway
  • Poland
  • Portugal
  • Romania
  • Slovakia
  • Slovenia
  • Spain
  • Turkey
  • United Kingdom
  • United States.
Nato soldiers in Serbia, 2021

Wia dis foto come from, Getty Images

Why Ukraine neva join Nato?

Nato tok for 2008 say Ukraine fit join at a future date, but decline dia September 2022 request for "fast-track" membership.

Article 5 of Nato charter say if one member dey attacked, all odas should come to dia defence.

If Ukraine join during di current Russian-Ukrainian conflict, Nato kontries go technically get to declare war on Russia.

Nato go impose no-fly zone?

Nato don already reject to helep Ukraine put no fly-zone ova di kontri say Russia air power and to protect civilians.

One reason be say, dem no wan get palava with Russian air forces. Anoda reason na say Nato planes, wey dey try protect demsefs from attack fit need to fire anti-radiation missiles (ARMs) for radar installations on Russian territory.

Russia fit use dis as reason to declare war on Nato kontris.

How di West dey help Ukraine for corner?

Some Nato nations don dey send weapons enta Ukraine in dia fight against Russia.

America don send $200m worth of weapons including Javelin anti-tank missiles and Stinger anti-aircraft missiles and dey let oda Nato nations send made in US weapons. Dem promise to send extra $350m (£261m) in weapons wey include Javelin anti-tank missiles, anti-aircraft systems and body armour.

Britain don send 2,000 short-range anti-tank missiles and promise more for future.

Germany dey send 1,000 anti-tank weapons and 500 Stinger missiles. Dem also drop some restrictions make oda konris fit send Ukraine made in Germany weapons.

Di Netherlands dey send sending 200 anti-aircraft missiles.

Belgium dey send 2,000 machine guns and fuel.

Sweden dey send 5,000 anti-tank weapons, helmets, body armour and rations.

Poland don start to send ammunition

Estonia and Latvia don start to dey send fuel, anti-tak weapons and medical supplies.

Di Czech Republic don promise guns and ammunition.

Slovakia don send ammunition and fuel.

Di EU say dem go spend reach 450m euros (£376m) to take buy weapons for Ukraine for di first time for dia history.