Iniobong Umoren story: Akwa Ibom state government call for 'full' justice afta murder of 20 year-old wey dem allegedly rape and kill for di state

Wia dis foto come from, Umoh Uduak
Akwa Inbom state goment don express dia sadness ontop di news of di death of Iniobong Umoren wey die afta one suspect, Uduak Frank Akpan, allegedly kidnap, rape and kill her.
Di govnor wey thank di police for di arrest and interrogation of di suspect, say dem don communicate to di Police hierarchy for di state, of im desire for di full administration of justice to di culprit and all persons wey involve for di crime. "We condemn in totality dis ogbonge tin wey lead to di loss of the life of an innocent young woman, wey bin just wan earn a decent living. Our state must remain safe location for all peace loving and law abiding citizens at all times.We commiserate with the deceased family on dis very painful loss and pray God to comfort dem." Di statement tok.
Dis one from di goment dey come afta Akwa Ibom State Police Command arrest 20 year old Uduak Frank Akpan for di suspected kidnap, rape and murder of Miss Iniobong Umoren.
Di statement wey di Police tok-tok pesin Odiko Macdon sign say na men of di Anti-Kidnapping Squad of di Command arrest di suspect from dia investigation.
On 29 April, 2021, @UmohUduak begin use #HinyNumoren to announce say her friend dey in trouble and she need help.
Uduak wey her twitter handle be Happiness Activist say her friend tell her say she dey go for one job interview for Airport road on April 29th, and she no return since den.
Police say dem exhume di deadibody afta di suspect lead dem go di place e bury her and dem don put her for University of Uyo Teaching Hospital UUTH pending autopsy.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Police say dem go charge am go court after dem finish dia investigation.
End of Di one wey oda users dey read well well










