How gunmen kill commissioner for Kogi, one police officer for Ebonyi

Adebayo Solomon wey gunmen kill

Wia dis foto come from, Channels TV

Gunmen don kill di commissioner of Pension Board for Kogi state, Adebayo Solomon.

We gather say dem kill di commissioner on Saturday while dem also kidnap di Chairman, Yagba East local goment area of di state, Pius Kolawole.

Report say Oga Adebayo dey travel from Ilorin di Kwara state capital to Kabba, Kogi state wen di unknown gunmen shoot at im vehicle for Eruku village wey no dey too far from Egbe, wey be di border town between di two states.

Dem don deposit im body for ECWA Hospital wey dey Egbe.

According to wetin di Police boss for Kogi state Ayuba Ede tell Channels TV, di command don begin serious investigate into di mata.

Dem still never find di council chairman wey dem kidnap.

Cases of kidnapping and robberies don dey serious for Kogi state recently.

Gunmen attack police station for Ebonyi, kill one officer

Meanwhile for Ebonyi state, unknown gunmen don kill one police officer afta dem attack Abaomege Police Station in Onicha Local Govment Area of di state.

Wetin we hear be say di jaduga pipo attack di station on Saturday night and begin dey shoot and injure one oda officer.

For inside statement police toktok pesin DSP Loveth Odah, say di gunmen enta di Abomege Divisional Headquarters around 10pm on May, 1st inside one white bus and destroy di make-shift barricade wey dey di entrance.

She tok say dem ''fatally wound'' one police Sargent Ofem Obeten and injure anoda officer, wey don dey receive treatment now for hospital.