Fadlullah Agboluaje: Autopsy reveal how Nigerian student Fadlullah Adebayo Agboluaje, die for im school hostel for Ukraine

Fadlullah Adebayo wey die for Ukraine

Wia dis foto come from, Facebook/Agboluaje Olaide

Nigerians in Diaspora Commission confam say Fadlullah Adebayo Agboluaje, one student wey die for school hostel for Ukraine last month die from extreme cold.

19-year-old Fadlullah Agboluaje, bin arrive for Ukraine on di 8th of January and dem report am dead one day afta.

According to di autopsy wey dem perform on am, Fadlullah die from extreme cold for Ukraine for im hostel room, NIDCOM tok.

Di Chairman of di Nigerians in Diaspora Commision, Abike Dabiri Erewa also pay condolence visit to im family wey blame dia son death on di school for negligence on di part of di liaison officer.

Twitter/NIDCOM

Wia dis foto come from, Twitter/NIDCOM

'I never hear from Ukraine school'

Fadlullah mama, Agboluaje Olaide, tell BBC Pidgin say di family don see di autopsy report and dem no fit question am sake of say dem no dey dia.

Di woman tok say dis no be di first time di boy go dey travel go overseas. She tok say di boy no dey suffer from any sickness before im death.

Olaide also tok say di school never reach out to dem to condole with di family since di incident happun.

"I never hear from di school. Dem no even care. Dem suppose condole wit di family but dem no reach out to us," Olaide tell BBC Pidgin.

Di woman also tok say she won pay her last respect to her son. According to her, if di school no fit send Fadlullah body, make dem allow her enter di kontri to pay her last respect.

'My brother bin no dey happy wit im accommodation'

Sister of Fadlullah Rofeeha Agboluaje bin go on social media to announce di death of her younger brother, Fadlullah Adebayo, wey leave Nigeria travel go Ukraine to study for Lviv Polytechnic National University.

Rofeeha tok say im brother bin no dey happy wit di accommodation wey dem put am after one representative of di school pick am up from di airport.

"Lviv Polytechnic National University representative na im pick my broda up from di airport to school accommodation facility on January 9, 2022.

"After im reach im room, he no dey happy wit di way di place look and my mum tell am to request for change of room," Rofeeha tok.

Rofeeha tok say im broda go di front desk of di accommodation facility to report to di personnel wey dey on duty.

Di deceased elder sister say after Fadlullah realise say di person no understand English, di boy reach out to di liaison officer wey im name and number dey inside di letter di school send to am before im leave Nigeria for Ukraine.

"Dis man tell my brother make im see am in di morning di following day by 7am," Rofeeha tok.

Rofeeha tok say her mama follow her broda tok till 11 on Sunday and on Monday dem no hear from di boy again.

Abike Dabiri Erewa visit Fadlullah Agboluaje family

Wia dis foto come from, NIDCOM

According to Rofeeha, her mama reach out to di liaison officer but she claim say di man bin dey dodge dia calls and keep dem in di dark.

"Di man pick im calls later dat evening and den give one student in dat accommodation facility di phone say make he break di news say dem see my broda dead on di floor of im room," Rofeeha tok.

Di woman also tok say Fadlullah no dey sick before im komot for Nigeria and e run different tests and di results show say e dey okay.

"Na big shock. My broda komot for Nigeria very healthy. He bin run Covid-19 test as at January 7 and im test negative. E bin get di full Covid-19 vaccination. E take im yellow fever vaccine, run complete health check for our family hospital and everything come out fine." Naso di woman tok.

Many Nigerians bin don sign petition to know wetin kill Fadlullah afta di deceased family request for 5,000 signatures online.

Oda times wen young Nigerians die for abroad

Dis Fadlullah incident no be di first time wey Nigerian go die abroad for circumstances wey bin no dey clear.

For, April 5, 2021 di Metropolitan police for UK get informate from colleagues from Essex Police say dem find deadi body of a man for one lake for Epping Forest.

Richard bin miss from im home for Ladbroke Grove on Monday, March 22, and dem report am missing on Wednesday, March 24.

For November 18, 2021, 41-year-old Nigerian man for Canada Oghenetega Ufuoma bin die for di North American kontri on .

Winnipeg Police Service confirm say di Nigerian man bin die suspicious death for Manitoba area.

Now one 38-year-old man wey dem dey call Nevis Carter dey arrested and police say dem don charge am with manslaughter for Oghenetega Ufuoma death.

Winnipeg Police Service bin confirm di case for inside press release wey tok tok pesin Cst. Dani McKinnon share with BBC News Pidgin.

According to police investigators, dem believe say Ufuoma and Carter dey always go River Avenue and Osborne Street.