Lil Loaded dead: Texas rapper die at di age of 20

Wia dis foto come from, Getty Images
Texas rapper Lil Loaded don die at di age of 20.
Di rapper lawyer, Ashkan Mehryari wey confam im death to BBC Newsbeat say di rapper take im own life. Im say e client death dey "very tragic" and unexpected.
Di official cause of death neva dey confirmed by di medical examiner.
Lil Loaded wey im real name na Dashawn Maurice Robertson, release di single 6locc 6a6y for 2019.
Di Dallas rapper chop arrest for 2020 on top murder charge in connection wit di shooting of 18-year-old Khalil Walker.
For February, e bin reportedly face accuse on a lesser charge of manslaughter.
Lil Loaded popular for viral track 6locc 6a6ym, wey receive over 29 million views on YouTube and e dey certified gold by di Recording Industry Association of America.
Im follow-up song, Gang Unit, na even bigger hit with over 39 million YouTube views.
End of Di one wey oda users dey read well well
For im last Instagram post, e say im get di "dopest fanbase on Earth" as e dey respond to di certification.
Lil Loaded bin tok say na Michael Jackson im listen to as im dey grow up and also get inspiration from artists like Lil Wayne, Snoop Dogg and The Game.
Lil Loaded: Profile of rapper

Wia dis foto come from, LIL LOADED/INSTAGRAM
Dashawn Maurice Robertson AKA Lil Loaded na American rapper, songwriter and singer. E hecome popular afta im "6locc 6a6y" go viral for di summer of 2019. Dem born Lil Loaded for August 1 for San Bernadino Californai, but im state of origin na Dallas.
Lil Loaded start im career as rapper for 2018, e become popular afta American Youtuber, Tommy Grzw include im song "6locc 6a6y" for one video reaction.
Lil Loaded record over 28 million views on Youtube for di song. Di song also dey certified gold.
He sign one record deal wit Epic Records and e release im first mixtape 6locc 6a6y for 2019 and im second mixtape CRIOTAPE for 2020.
For 2020, Lil release another hit single Gang Unit wey record over 39 million views on Youtube.
Di rapper lease im first album "A Demon In 6lue" for 2020. Di album feature popular American musicians' lilke Polo G, Nle Chopper and YG. Im album enta N0 19 on di US Heat Chart.
According to reports, Lili Loaded bin shoot and kill im 18 year old friend Khalia Walker for February 2020 as e dey record one music video. He submit himself to police on November 9, 2020. Dem charge am wit accuse of manslaughter for February 2021.
For di summer of 2020, di rapper bin do one Instagram live video for hospital bed. E claim say dem shoot am.
On May 31 2021, tori of im death go viral.
According to FamousBirthsDeath, Lil dey estimated to worth $350,000.





!["NECO Registrar dead": [Professor Godswill Obioma death] and 'how di NECO boss die'](https://ichef.bbci.co.uk/ace/ws/660/cpsprodpb/E840/production/_118765495_e2y4ermxeamr4ed.jpg.webp)






