Carlos Ahenkorah: ‘I grab ballot papers sake of I want cause rerun’– Ghana MP wey snatch ballot papers for parliament apologize

Carlos Ahenkorah

Wia dis foto come from, JoyNews

Ghana lawmaker wey snatch ballot papers during de voting for Speaker of parliament say he try snatch de ballot papers sake of he dey want rerun of de elections.

According to Mr Ahenkorah, "like I want create situation for rerun. Just like how my colleagues from de other side take de ballot box away on 3 occasions."

"So I also grab some ballot papers before dem go count am so say we go do another rerun… I make heartbroken and sad" Carlos Ahenkorah explain.

Mr Ahenkorah during de voting process to determine who go become speaker of parliament snatch ballot papers during de collation process.

De NDC MPs mount hot chase for Carlos Ahenkorah wey dem ctach am, retrieve de ballot papers.

As part of en explanation for what happen, Mr Ahenkorah apologize for en actions but explain say de NPP inside him push am to snatch de ballot papers.