Ghana Speaker of Parliament: Lawmakers vote NDC Alban Bagbin as new leader

Wia dis foto come from, Other
Opposition NDC Candidate, Alban Bagbin win Speaker of Parliament election for Ghana. Per declaration of de results, NPP dey control Executive arm of govment wey NDC dey control legislative arm of govment.
NDC lawmakers bin dey inside jubilant mood ahead of de declaration of results afta de voting process to determine who go be next speaker of Ghana parliament end.
Major tension bin dey for Ghana as NPP den NDC members clash over who go be de next Speaker of Parliament.
After three attempts at voting since dem no fit reach decision as some members carry ballot box away, others kick de box den tins over secret ballot concerns.
Armed military officials enter parliament to settle de matter but lawmakers insist dem for exit de chamber.
Earlier, last minute ruling by one Cape Coast High court grant injunction against NDC Assin North MP-elect, James Gyakye Quayson from holding himself as MP elect.
De court arrive at dis decision after petition filed by one Michael Ankomah who claim say de NDC MP-elect dey hold Canadian citizenship at de time wey he file en application to contest in de December election.
According to de judge, Kwasi Boakye said during en ruling "de NDC MP-elect for restrain from holding himself as Member of Parliament-elect for the Assin North constituency within de Central Region of de Republic of Ghana wey he no for present himself for swearing in as Member of Parliament-elect until de final determination of de petition."
End of Di one wey oda users dey read well well
De judge make dis ruling on Wednesday, January 6, 2021, few gours to de dissolution of de 7th Parliament, after around 12.01am on January 7, 2021 newly elected MPs go form de 8th Parliament under de Fourth Republic.
Per dis ruling de NPP now get majority in parliament with 137 seats, while de NDC lose one seat which dey give dem 136 seats.
De NDC MP-elect lawyers try file stay of execution against de court ruling but dem say de court clerks no dey post at de time dem arrive.
Dis be some of de key things to note from January 6 to January 7, 2021 when dem go swear in President Akufo-Addo.
Dissolution of 7th Parliament
On Wednesday 6th January 2021, Ghana go dissolve de 7th Parliament around midnight, dis dey follow Article 113(1) of de 1992 Constitution of Ghana.
After de dissolution, around 12:01am on 7th January, de Elected Members of de 8th Parliament go gather for de Chamber of Parliament to elect a Speaker den Two Deputy Speakers.
After dis, de new Speaker go swear in de newly elected Members of de 8th Parliament.
In de morning of de 7th January, 2021 dem now for swear in President elect, Nana Akufo-Addo before de newly constituted 8th Parliament.
Majority and minority fight over Speakership
De decision of who go be Speaker of Parliament make sketchy because of de number of seats both NPP and NDC get each for Parliament.
Sake of dis, wen it comes to de voting for new Speaker, political analysts dey talk say dis be difficult issue.
De NPP wan bring back Professor Mike Oquaye, who be Speaker of de 7th parliament wey one of de people de NDC wan nominate as speaker be former NDC majority leader, Alban Bagbin.
However, de NPP be hopeful say when it comes to voting, de one independent candidate for Fomena who previously be NPP lawmaker go vote give dem.
Members of de 8th Parliament go vote for Speaker, First Deputy Speaker, den Second Deputy Speaker of Parliament.
After which de newly elected speaker who de 275 members vote for through secret ballot, go now swear de new members in as lawmakers for Ghana.
January 7 swearing in of Prez
On January 7, 2021 dem go swear in President elect Nana Akudo-Addo before de 8th Parliament in accordance with Article 57(3) of de 1992 Constitution of Ghana.
After de swearing in happen, de President go fit start en duties as head of state by appointing ministers den things who he go work with.











