BBNaija: How housemates nominate, Laycon, Nengi, Kiddwaya, odas for eviction for dia first Big Brother Naija 2020 session

Laycon, Lucy, Neni, Kiddwaya and Vee

Wia dis foto come from, BBNaija

Trikytee, Laycon, Lucy, Vee, Nengi and Kiddwaya dey up for possible Eviction in di first Nomination session by di Housemates.

Dis wa na afta Biggie introduce new twist inside di middle of Big Brother Naija season 5 wia di Housemates go nominate who dem feel make e go house. Dem do di voting process differently in di first six Sunday Night Eviction Shows wia di Housemates Vote for who go go home from di bottom four Housemates with di least votes.

After Monday night HoH games wia Erica win for di second time dis season and pick Prince as her Deputy, one by one di Housemates enta Biggie Diary Room to pick di two Housemates dem feel make e dey up for possible Eviction dis week.

See how di first Housemates Nomination Session go down:

Lucy

Nengi and Trikytee

Kiddwaya

Lucy and Trikytee

Dorathy

Vee and Laycon

Laycon

Trikytee and Lucy

Nengi

Lucy and Laycon

Trikytee

Lucy and Laycon

Vee

Trikytee and Dorathy

Ozo

Lucy and Kiddwaya

Prince

Nengi and Ozo

Neo

Kiddwaya and Lucy

Erica

Vee and Laycon

In the end, Lucy get di most Nominations at six, Trikytee and Laycon receive four Nominations while Vee, Nengi, and Kiddwaya all get two Nominations each.

Na on Sunday e go clear who go go house inside di housemates wey dey up for eviction.