BBNaija Head of House 2020: Erica win HoH make Prince Deputy for Big brother Naija lockdown season 5 house

Wia dis foto come from, BBnaija
Ngozi Nlewedim AKA Erica don become di new head of house of Big Brother season 5 afta she win di HoH Challenge dis evening.
She pick Prince as her Deputy Head of House which mean say im self go chop immunity from eviction dis week.
Dis go be di second time wey Erica dey win di position as head of house inside Big Brother Lockdown Season 5 as she bin don win am before for di third week in August.
As Head of House, Erica don get automatic immunity for dis week eviction and exclusive access to di Head of House Lounge for di week.
Her Deputy, Prince also get di same power and privilege to enjoy all di benefit wey HOH get.
Dis latest win go make Erica di second pesin to win Head of House title twice afta Ozo.
Later dis evening, di house mate go enta di diary room to nominate dia fellow house mates wey go dey up for eviction dis week.
Already three pesin; Wathoni, Brighto and Tolanibaj na im leave di lockdown house on Sunday as e be say na dem get di lowest votes from viewers.
End of Di one wey oda users dey read well well












