BBNaija: Erica, Prince, odas reveal ‘tins’ for Big Brother Naija Diary room challenge wey happun among housemates

Wia dis foto come from, Big Brother Naija
For di start of dis week, Big Brother collect leave come leave HoH Kiddwaya in charge, question wey bin dey for pipo mind be say who go run diary room.
But on Thursday, challenge come say make di housemates dem be each other "biggie" and di tea wey comot di mata no be small.
Di rules na say pipo go pick dia "biggie" randomly from box
Dis na some of di tins dem tok.
Erica and Wathoni confrontation
Afta di gbas gbos wey happun between Erica and Wathoni before dis challenge, na Erica come pick Wathoni as her biggie oh.
Erica reveal during dia yan say she recently find her papa on top social media and neva even meet di guy for real life as she still dey reason di mata.
On top di mata, she tok sorry say she no mean to insult Wathoni on top say she be single mama because na single mama sef raise am.

Wia dis foto come from, Big Brother Naija
Prince wan 'break up' Erica and Kiddwaya
Prince reveal for im own diary session wey na Erica be im biggie say, if e fit break up any couple for di house, e go be Erica and Kiddwaya straight to her face.
End of Di one wey oda users dey read well well
E say di mata go end for premium tears on top say Kiddwaya just dey infatuated with Erica and im admire Erica na why e tok like dat.
New Ship dey di air?
One of di questions for di 'biggie' session na who you go ship with. Trikytee with no regret say e go choose Dorothy sharparly.
E tok say e for pick Wathoni except di wahala inside be say she too dey emotional.m.?











